You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Niger, Nigeria and Burkina Faso pipo among undocumented migrants Ghana send back to dia kontris
Di Ghana immigration service don arrest more dan 600 migrants for one operation for di Ashanti regional capital, Kumasi.
According to di immigration authorities, di operation target places for di region wia dis pipo don get networks wia dey beg for street for Asawase, Alabar, Akwatia Line, Dagomba Line, Sabon Zongo and Aboabo.
"Out of di 606 pipo wey chop arrest, 381 be pickins, 72 be females wey 153 be males. Many of dis pipo we rescue be victims of human trafficking and forced begging," di immigration service explain inside one statement.
Dis pipo be "vulnerable wey pipo for trafficking networks wey bin dey move women and children across borders".
Di latest action by di authorities dey in connection wit one campaign by di immigration service across di kontri against wetin dem describe as "organized street begging networks."
Local authorities and residents for Kumasi bin complain about di foreign beggars for di street.
Di immigration service dey profile di latest batch of pipo dem arrest wey dem go take further action.
Authorities carry 365 West African nationals go dia kontris
Earlier di Ghana immigration service for one operation for parts of Accra rescue ova 300 West Africa nationals for 15 April.
Di operation happun for places like Abossey Okai, Zongo junction, Nima, Madina and Kaneshie.
Out of di 305 pipo, 113 be children, 66 adult women and 126 adult men. Out of di 113 children – 36 be male wey 77 be female.
Immigration authorities carry 365 West African national go dia home kontris for Niger, Nigeria and Burkina Faso.
"In line wit di Ecowas free movement protocol wey dey guarantee visa-free travel, residence and respect for di rights of citizens of member states, di Ghana immigration service for dis operation dey target only criminal exploitation and irregularities."
Immigration officers in collaboration wit di Nigerian High Commission for Accra don help 89 Nigerians to regularize dia documentation wey dem hand dem ova to "relevant anti-human trafficking authorities for Nigeria."
Dem also dey engage various diplomatic missions for Accra to ensure protection of vulnerable children.
Oga for di immigration service Samuel Basintale Amadu say "di service dey committed to protect di kontris borders and enforce di immigration laws."