BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Iran dey offer $66,000 reward to capture American crew member afta dem shoot down US fighter jet
Di missing airman, one weapon systems officer, bin dey inside one US F-15 fighter jet wey dem shoot down for southern Iran.
Wat next for ADC?
ADC say dem don plan and schedule how dia Congress go take waka despite say Inec dey derecognise di acting National Working Committee of di party, ahead of di 2027 election.
Presidency defend why Tinubu console Plateau attacks victims for Jos airport afta dragging
President Bola Tinubu say from Plateau, im go "proceed to Lagos to observe Good Friday, and den continue wit scheduled engagements for Ogun, Lagos, and Bayelsa focused on infrastructure, trade, and economic growth".
We dey near World War Three or na fear full bodi?
More dan one month into di conflict, pipo dey fear, odas dey show concern ova weda e fit scata into ogbonge war.
Trump replace US attorney general Pam Bondi
Deputy Attorney General Todd Blanche go now work as acting attorney general, while di Trump administration go give Bondi new role, CBS tok.
Wetin Inec decision to derecognise ADC wey David Mark dey lead mean for di party
Di African Democratic Congress (ADC) don reject di decision of di Independent National Electoral Commission (Inec) to derecognise di party national working committee members
Fresh violence for Jos Plateau State afta Angwan Rukuba attack wey kill more dan 20 pipo
Dis dey hapun just days afta one attack by some armed men kill at least 26 pipo for Angwan Rukuba community for Jos North local govment area.
Trump don land for Supreme Court ova birthright citizenship mata
Trump start di gbege wit di executive order wey im bin sign for im first day back for office to comot automatic birthright citizenship.
African kontris wia homosexuality dey illegal and wetin dia laws tok
Senegal President Bassirou Diomaye Faye don sign one new law wey guarantee 10 years maximum prison term for sexual acts by same-sex couples.
Ginger Me
Special Tori
Tinubu ministers, appointees wey don resign ahead of 2027 general elections
Four ministers of President Bola Tinubu cabinet don resign from dia office, according to di directive wey di president bin give.
Peter Obi rate Tinubu visit to Jos, but wetin dey cause attacks for Plateau State?
All dis dey come afta a Palm Sunday kasala for di Angwan Rukuba area of Jos North Local Government Area of Plateau state wia gunmen attack and kill at least 28 pipo wit many injured.
Who be Christopher LaNeve, di man wey go lead di US army for di middle of war wit Iran?
E go replace Randy George, wey di Defence Secretary Pete Hegseth ask to step down from di post
Key takeaways from Trump primetime speech on Iran war as Tehran cut warning give US
Di 20-minute speech from di Cross Hall for White House na di first since di war start.
'We dey go for all humanity' - emotional moment as Artemis II blast off enta space
Evriwia bin dey shake as brilliant white flame begin go up suddenly, afta sometime di white smoke cova di whole launch pad as di biggest rocket wey Nasa don eva build rise into di sky.
Lagos State extend tax returns filing deadline - how to file individual tax returns
LIRS make di informate on Monday 30 March for one press statement wey di Head of dia Corporate Communications, Monsurat Amasa-Oyelude, sign.
South Africa dey consider to reduce fuel levy sake of Iran war, official tok
South Africa dey adjust fuel prices monthly and dey use formula wey dey factor in movements in global crude oil prices, di exchange rate and local taxes such as di fuel levy.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































