Wetin US lobbying firm wan do for ADC inside dia kasala wit Inec?

Read am in 5 mins

Since ogbonge politicians don begin defect to di Action Democratic Congress (ADC) dem don be like di di major opposition party for Nigeria.

As dem dey join forces ahead of di 2027 General election, e be like say plenti wahala dey follow dem.

Di latest na as dem announce say dem go work wit one US firm wey go help dem present dia mata to di US congress afta Inec say dem no go recognise di party chairman sake of litigation for di party.

Dis make one Nigeria online tori pipo Sahara Reporters to find out about di company, inside on tori wey dem bin publish on Saturday dem describe di firm as pipo wey get "only one client" and "zero revenue in 2025."

Tori bin spread say di African Democratic Congress (ADC) hire one United States lobbying firm wey no too dey popular, Von Batten-Montague York L.C., to intervene for di Nigeria electoral kasala wey involve di Independent National Electoral Commission (Inec).

'At best dis na careless reporting' - US firm tok

Di company, Von Batten-Montague-York, L.C. react afta tori wey Nigerian online newspaper Sahara Reporters bin publish on Saturday.

Sahara Reporters for dia headline say "ADC hires US lobbying firm with 'only one client, zero revenue in 2025' to influence Trump administration on Inec stalemate".

Di US company say dem dey surprised by di tori and e also shock di pipo wey dem dey work wit and all dia clients. Dem clear di air say dia firm dey represent foreign govments and international entities, wey di Justice Department dey monitor.

Dem tok say di place wey media platform claim say get dia tori from no correct.

"Di problem wit am dey simple: OpenSecrets dey track Senate lobbying disclosures, wey dey designed for domestic lobbying clients, no be foreign principals. Our clients in 2025 all na foreign entities, dem no be local U.S. entities."

So wen Sahara Reporters cite Open Secret to support dia inaccurate claims, e dey either reflect a fundamental misunderstanding of U.S. law or a deliberate attempt to mislead di Nigerian public."

Di US firm describe di tori wey Sahara Reporters do as "entertaining and a complete work of fiction".

" At best, dis na careless reporting. At worst, na a coordinated narrative designed to distort facts to push current Nigerian govment political interests."

SaharaReporters quote one political analyst wey tok say "Dis na complete joke," "You no go claim to dey defend democracy and den turn around to hire a firm wit virtually zero record, no visible influence, and questionable capacity to engage di U.S. Congress or any serious administration figures."

On 2 April, 2026, Von Batten-Montague-York, L.C. post for dia verified X handle say Inec don withdraw recognition of di leadership of di African Democratic Congress (ADC) and suspend all official engagement wit di party sake of court mata.

Di firm expain say di action freeze di main opposition political party for a critical moment as dem dey prepare to compete for di upcoming Nigerian presidential election.

Dem add say di action dey raising serious concerns about di ability of di opposition to organize and participate fully for di democratic process.

"At a time wen Nigerians dey expect free, fair, and credible elections, any development wey dey disrupt political participation, create institutional uncertainty, or undermine di perceived independence of electoral bodies must dey addressed wit urgency and transparency.

"Nigeria no be only Africa largest democracy, but na also a critical strategic partner of di United States for regional security, economic stability, and counterterrorism. The integrity of Nigeria electoral process dey of direct importance to US interests and global stability."

"Accordingly, we go present dis concerns to members of di United States Congress and the DonaldTrump administration to ensure di importance of free, fair, and transparent democratic processes for Nigeria remain firmly on di international agenda."

Dem also call on Nigeria President ensure, Bola Tinubu to make sure say di conduct and outcome of di 2027 elections dey beyond reproach, make dey dey free from doubt, and make e show say na wetin Nigerian pipo really want..

Wetin bin happun to ADC

Nigeria opposition party African Democratic Congress (ADC) earlier challenge di decision of di Independent National Electoral Commission (Inec) say dem go go ahead to hold dia Congress.

ADC say dem don plan and schedule how dia Congress go take waka despite say Inec dey derecognise di acting National Working Committee of di party, ahead of di 2027 election.

Dis dey come afta di ADC reject di decision of Inec to remove di names of dia National Chairman David Mark, National Secretary, Rauf Aregbesola plus names of oda National Working Committee members comot dia portal sake of one court of Appeal Court ruling wey neva settle.

Inec announce on 1 April 2026 say dem no go receive any 'further communication or deal wit any of di parties or groups on issues wey concern di affairs of di party.'

Inec come add say dem no go monitor any meeting, congress or convention on wey any of di two parties fo on behalf of di African Democratic Congress (ADC) 'until di Federal High Court decide on di matter.'