'Nigerians no get any interest to destabilise South Africa' - Nigeria

Read am in 5 mins

Nigeria Embassy for South Africa don react to di recent violence wey happun for Eastern Cape for South-Africa on Monday.

Representative to Temitope Ajayi, di deputy high commissioner of di Republic of Nigeria to di Republic of South Africa, during one interview wit SABC, tok dis wen e bin address South-Africa protesters wey gada for front of Nigeria Embassy on Tuesday.

Di tok-tok pesin tok say Nigerians for South Africa dey obey laws for oda kontri and dem no get any interest to destabilise dia kontri.

E tok say Nigeria na friend of South Africa and add say during di apartheid, Nigerians play ogbonge role to support South Africans.

E tender apology to di South African traditional institution while e insist say Nigeria no get interest to hijack dia kontri or dia traditional institution.

"Di nation wey dem dey call Federal Republic of Nigeria no get any interest to destabilise South Africa.

"E dey unfortunate say dis tin dey happun di way dem dey happun, but I wan make you know say Nigeria no dey here to destabilise South Africans or destabilise di kontri."

"Nigeria na friend of South Africa, some pipo fit no know but we go need go back to history, just as you tok during apartheid Nigeria play great role," e tok.

Nigeria govment advise citizens for South Africa to take caution afta community leadership issue spark protest

Nigeria govment don ask dia citizens wey dey live for South Africa to limit movement and avoid public gatherings as tensions remain high.

Di Nigeria High Commission for Pretoria wey issue di advisory on Monday night warn dia citizens to exercise caution following di violent protests wey break out for di Eastern Cape city of KuGompo, previously known as East London.

According to reports, na di coronation of one Nigerian community leader Solomon Egbonna Eziko, wey dey recognised by members of di local diaspora as "Igwe Ndigbo Na East London" trigger di protest.

Chief Solomon Ogbonna Eziko bin collect title as di Igwe Ndigbo Na East London two weeks ago.

Na various civil society groups and political parties organise di protest. Di demonstration bicom violent afta one of dem claim say one foreigner stab am during di demonstration.

Di angry protesters burn shops wey belong to both foreign nationals and South Africans and set at least 10 vehicles on fire. Di protesters force businesses to close, and police use rubber bullets to disperse crowds.

Police tok say dem don begin investigate di mata, although dem neva make any arrest.

Di mayor of di town Princess Faku don condemn di violence. "We support di march becos na part of di efforts of defending our sovereignty, but we no tolerate violence. Violence no dey solve problems…e dey veri sad say dis kain important march later turn into violence and chaos".

Provincial authorities and cultural experts don also condemn di coronation as unlawful and violation of customary protocols.

One meeting between di high commissioner of Nigeria and various South African govment representatives dey scheduled to take place on 8 April.

Wetin we know

For videos wey don dey spread on top social media, e show say kasala don burst for di protest wey lead to di burning of private property.

Di coronation bin take social media by storm as one joinbodi of traditional leaders reveal say e dey against di customs to claim Kingship ova area wey alreadi get traditional leader.

Di Chairman of di Eastern Cape House of Traditional and Khoisan Leaders (ECHTKL), Nkosi Mpumalanga Gwadiso, tell local tori pipo, TimesLIVE say di area dey under di amaRharhabe kingdom wey dey di hand of King Sandile.

Di kontri public broadcaster, SABC, bin report say na di KuGompo city NGOs and di Eastern Cape residents bin gada for road to protest di mata and even at den di department of Cooperative Governance and Traditional Affairs (COGTA) and di Buffalo Municipality don come out to condemn di mata.

Prince Xhanti Sigcawu wey come from di Amathole House of Traditional Leaders call for di deportation of pipo wey get dia hand for inside di so-called coronation as e tok say, "I dey vex say Nigerians fit come hia and claim say dem get king for hia".

Di Eastern Cape co-operative governance and traditional affairs MEC Zolile Williams, e say im department hand no dey inside di so-called installation of king by foreigners of di province.

All dis one dey come as di Nigerian Union for South Africa bin try clear di air on wetin di crowning of Nigerian King for East London actually mean.

Dem tok say di move na just ceremonial title wey dey given to preserve di culture of Nigerians wey dey live for abroad and no go affect di local establishment of di host kontri, according to tori wey SABC bin report.

Nusa president Nwobi Smart reportedly say: "Dis Cultural Ambassador go look to be di middle man between local authorities of di Nigerians wey dey stay for dis areas including di middle man for di embassy or consulate in case say somtin sup wia dem find say Nigerian nation don commit."

E add say "na dis cultural ambassador wey dem go call to chook mouth if attacks dey inside di locality".