Wetin di 'No Kings' protest against Trump dey about?

    • Author, Sakshi Venkatraman
  • Read am in 5 mins

Large protests against di Trump organisation don dey happun for cities round di US. Dis go make am di third kain 'No King' rallies wey don carry crowds wey reach millions bifor.

Organisers tok say dem dey protest against policies wey US President Dnald Trump bin impose wey include di war for Iran, federal immigration enforcement and di rise in cost of living.

Organizers tok say, "Trump wan rule as tyrant. But dis na America and power, na di pipo own am not wannabe kings or dia billionaire cronies".

One White House tok-tok pesin call di protests say na "Trump Derangement Therapy Sessions" and di only pipo wey care "na di tori pipo wey dey paid to cover am".

Throughout di day on Saturday, protests happun for almost all di major US city, wey include New York, Washington DC, Los Angeles, Boston, Nashville and Houston.

Dem bin also gada for smaller cities and towns round di kontri.

Rallies bin take ova di streets of downtown Washington DC throughout di afternoon like plenti pipo march through di kontri capital.

Protesters bin line di steps of di Lincoln Memorial and pack demsefs for di National Mall.

Like for di last No Kings, protesters bin hold likeness of Turmp, JD Vance and oda officials for di administriation wey dey call for dia removal and arrest.

One of di flagship No Kings protests on Saturday happun for Minnesota wia two American citizens, Renee Nicole Good and Alex Pretti bin dey killed by federal immigration agents for January. Dia deaths bin cause serious vex and nationwide protests against di Trump goment immigration tactics.

Thousands on Saturday bin waka for street wit signs and plethora of high-profile Democrats wey go on stage for outside of di State Capitol building for St Paul.

Bruce Springsteen bin also climb stage and bin perform im anti-immigration enforcement song wey im call "Streets of Minneapolis".

Thousands bin also gada for Times Square for New York City as dem march through di Manhanttan Midtown neighbourhood.

Police bin need to shutdown di streets wey normally dey busy so crowds go fit pass. For October, di New York Police Department tok say ova 100,000 pipo bin gada for all di five city boroughs.

Di protests bin no go witout comma sha. For Los Angeles, two pipo don arrested say dem assault federal law enforcement, according to di Department of Homeland Security (DHS).

For statement wey dem release for X dem tok say dem nack two officers wit cement blocks and dme dey collect medical care afta group of wetin dem call "1,000 rioters" bin surround di Roybal Federal Building and start to dey throw tins for di DHS agents.

Elsewia for di city, di Los Angeles Police Department say "multiple arrests" bin dey made afta protesters no gree obey orders to comot one area near federal prison.

Police confam say federal authorities use "non-lethal measures" to comot di crowds for di area afta dem warn protesters make dem no "attempt to tear down di gate and not throw items".

Reuters report say dem also arrest pipo for Dallas afta "small-small kasala bin burst" wen counter-protesters bin block streets and scata di No Kings march.

American expats abroad also gada for protests for cities like Paris, London and Lisbon.

Di last No Kings rally for October bin draw crowds of almost seven million pipo nationally.

Several US states bin mobilise di National guard but organisers don maintain dat di events dey peaceful.

Since President Trump enta di White House again for January 2025, e don expand di scope of presidential power wey use executive orders to scata parts of di federal govment and deploy National Guard to US cities even though di state govnors don refuse.

Di president don call on di administration top law enforcement officials to prosecute im percieved political enemies.

E say im actions dey necessary to rebuild kontri wey dey in crisis and don dismiss accuse say e dey act as dictator say e dey hysterical.

E tok for interview wit Fox News for October tok say, "na dem dey call me King, I no be King".

But critics don warns say some of di moves from im administration dey unconstitutional and na threat to American democracy.