Why UAE dey pay di highest price for US-Israel war wit Iran?

Read am in 6 mins

As di war for Iran enta di fourth week, di United Arab Emirates don become di obvious target for Tehran.

Iran, change dia strategy as dem stop to focus only on confronting Israel, dem begin launch thousands of drones and missiles toward di member states of di Gulf Cooperation Council.

During dis fight, Tehran don carry out dia earlier threats to target U.S. bases for di region, wit special focus on di UAE— one clear message to Washington and Israel, wey dia relationship wit Abu Dhabi strong well-well.

By expanding di scope of di conflict, Iran dey try to increase di cost of di war for all sides and to also force di Persian Gulf states to pressure di United States to accept ceasefire.

In response, Abu Dhabi don adopt one unusually harsh tone towards Tehran, as dem threaten to join US-led efforts to secure di Strait of Hormuz, one move wey mark a departure from dia traditional approach of dialogue and good neighbourly relations.

Wetin be di extent of Iran attacks for di Persian Gulf?

Media for di region report say Iran no dey aim Israel wey dey battle wit dem, but dia target na di Persian Gulf states, especially within di first two weeks of di war.

Al Jazeera Qatar report say statistics of attacks for di first 11 days show say "Israel no be Tehran primary target," dem note say Israel experience only 433 attacks, while Arab countries don suffer 3,100 attacks.

Statistics wey regional media provide about Iranian attacks for di first three weeks of di war show say dem target UAE pass oda Arab countries.

Di Head of Dubai Centre for Public Policy Research Mohammed Baharoun, tell Abu Dhabi-based Sky News Arabic say one possible explanation na say Tehran see UAE as "di easiest prey" and "di first piece for inside domino effect."

Oga Baharoun say, "Iran leadership get one assumption say if dis piece fall, oda pieces go follow."

Which targets for di UAE don dey attacked?

Since di start of di war, Iran don target several key locations for di UAE, wey include di:

  • Habshan gas facility
  • Bab oil field
  • Dhafra air base
  • UAE biggest port and oil storage facility, Fujairah
  • and Dubai International Airport.

Two drones bin also target di UAE consulate for Erbil, wey dey Iraqi Kurdistan region.

One tok-tok pesin for di Khatam al-Anbiya Central Headquarters, Ibrahim Zulfiqari bin ask residents wey dey live for di heavily populated areas of di UAE say make dem no near "American ports, docks, and hideouts for UAE cities" to protect dia safety.

E add say Iran get di "legitimate right" to target US missile launch sites for di UAE in self-defence.

Iran accuse di UAE say dem allow US and Israel use dia territory to attack Iranian positions, wey include attacks on diislands of Kharg and Abu Musa from Ras al-Khaimah.

UAE don deny dis allegations.

Which impact di Iranian attacks don get on UAE economy?

Di United Arab Emirates wey for long dey known as di region economic, digital, and media hub, don dey severely affected by di war.

Beyond di immediate security risks wey di Iranian missile and drone attacks pose, di Abu Dhabi General Market Index, wey be di main index of di UAE stock market, bin record di biggest decline among Gulf markets, e fall to 42.11 percent in di past month, according to Trading Economics data through March 23.

UAE tourism and aviation sectors also suffer heavy losses sake of di closure of airspace and widespread flight cancellations. Dubai airport na di world busiest airport for international passengers.

On March 8, Iraqi media outlet Al-Ghad Press report say six airports for di Persian Gulf bin suffer losses of $399 million for di first week of di war, UAE share dey at about $95 million.

Iran also attack UAE energy sector. According to Reuters, UAE daily oil production don reduce by less dan half sake of di closure of di Strait of Hormuz.

Al-Mahriyah, wey dey focus heavily on eastern Yemen and dey critical of di UAE, don call Abu Dhabi di "biggest loser" for di conflict inside one 11 March report. E add say di UAE image for di international community don "spoil."

Di report also note reduction in oil production afta attacks on di Royce refinery plus di Fujairah oil hub.

Wetin be di measures Abu Dhabi don take?

Emirati officials and media don try to maintain di kontri image as a "safe haven" for di region.

UAE President Mohammed bin Zayed for im first message to im kontri pipo and residents assure dem say "all is well" and e say di kontri dey "fully prepared" to deal wit emerging threats.

Meanwhile, Hamad Saif Shamsi, UAE Attorney General, don warn pipo to stop to dey take foto, post or repost images and videos of Iranian attacks inside di kontri.

Di order don lead to di arrest of many foreign nationals wey bin publish real or fake images of Iran attacks and di aftermath for di country. Dem now dey face charges wey carry a minimum of one year in prison plus a fine of 100,000 dirhams (wey pass $27,200).

Earlier, di United Arab Emirate Minister of State Lana Nusseibeh bin call on Iran to end dia strikes on countries for di region and vow say her country go "bounce back".

Dem don send more dan 1,800 drones and missiles go UAE since di war start, she tok.

Di extent of di attacks come as "shock", she tell BBC.

Some of di UAE best known buildings don destroy - wey include Fairmont The Palm hotel, for di luxurious Palm Jumeirah area, plus di Burj Al Arab hotel.

Drones don land near di Dubai International Airport and thousands of flights to di UAE don dey cancelled.

However Nusseibeh bin refuse to comment on weda her country go retaliate militarily against Iran.

"We bin dey clear prior to di start of dis escalation say di UAE no go allow dem use dia territory or airspace for any attacks against Iran," she tok.

Wen BBC ask her if retaliatory strikes dey off di table, she ansa say: "We go reserve di right for collective self defence under international law."

Wetin be di impact of dis situation on relations between di UAE and Iran?

Since 2021, signs of improving relations between Abu Dhabi and Tehran begin show; one process wey go up afta agreement between Iran and Saudi Arabia for March 2023, wey China mediate.

UAE bin agree to di relations sake of dia economic interests plus dia ambition to establish their sef as regional power in quiet competition wit Riyadh.

However, di current war don scata any relations wey dey between UAE and Iran, and e don trigger wave of mutual accusations and threats.

Earlier dis month, UAE bin close dia embassy for Tehran and recall dia ambassador and diplomatic staff afta Iran attacks on dia soil.

Dem also summon Reza Ameri, Iranian ambassador to Abu Dhabi, to deliver one "strong note of protest."

Despite messages from di Gulf Cooperation Council wey emphasise dialogue, some media reports suggest say Saudi Arabia and di UAE dey "on di verge" of joining di war against Iran, one move wey fit destroy any remaining prospects for repairing relations between Abu Dhabi and Tehran.