APC candidate senator Monday Okpebholo become Edo govnor-elect
Live updates from Edo state as Inec dey ready to announce results from di Saturday govnorship poll.
Summary
Inec don resume for Edo state collation centre
PDP members dey protest outside INEC office for Benin
Security dey beefed up for Inec collation centre afta Obaseki drama
Inec say dem go begin announce results by 10:00am
Security agents escort Edo state Govnor Godwin Obaseki out of collation centre
Live Coverage
Helen Oyibo, Annette Arotiba
Una bye bye
Na hear we go end our coverage of di Edo state governorship election.
Di election wey start yesterday end wit di emergence of Monday Okpebholo as di govnor-elect of Edo state.
We thank una as una tanda wit us during dis coverage.
We go be wit una again for di Ondo state governorship election
INEC declare APC Monday Okpebholo winner
Di Independent National Electoral Commission don declare Monday Okpebholo winner of di Edo state govnorship election wey just end.
According to di results of polls from di18 local govment areas for di state as Inec announce on Sunday, Okpebholo gbab total of 291,667 votes.
Di APC candidate bin also win for 11 out of di 18 local govments wey dey di state.
Fotos of APC leaders as dem gather dey congratulate Okpebholo
Leaders of di All Progressives Congress bin gather round Monday Okpebholo to celebrate dia win for di just concluded polls for di state.
Although di returning officer for di state, is Prof Faruk Adamu Kuta, never officially declare Okpebholo winner of di election but na APC dey lead for di results wey dem don announce.
PDP win Ikpoba Okha Local govment
Di Peoples Democratic Party win for IKPOBA OKHA LGA:
PDP poll - 26,382
APC- 16338
LP- 4,026
Dis na di result of di last loval govment wey Inec bin dey wait to arrive.
Di returning officer for di state go announce di winner of di governorship election anytime from now.
One more LGA to go bifor INEC announce winner of Edo Govnorship election
Di state returning officer for di Edo govnorship election, Professor. Faruk Adamu Kuta, still dey wait di remaining one local govement result to arrive dia office bifor im finally announce winner of di election.
Di result for Ikpoba-Okha local govment neva arrive sake of say dia RAC collation neva finish. Di returning officer say di result go enta.
As at 6:36 pm Sunday 22 September, authorities say di result go arrive in less dan one hour.
Edo governorship election result by Local government
Edo State govnorship election: 'I dey disappointed' - Asue Ighodalo
APC win Oredo LGA
Di All Progressives Congress win Oredo LGA wit:
APC- 30,780 votes.
LP- 5389
PDP - 24,938
PDP members dey protest outside INEC office for Benin
A number of PDP supporters don storm Inec office area amidst heavy security deployment.
Dem gather to protest di election result wey di electoral commission dey announce.
Di supporters say dem no gree for di results wey dem dey see.
Na Monday Okpebholo so far dey lead di polls, from di result wey Inec don annouce,
Election observers express concern on di transparency of di ongoing results collation for Edo
Accredited civil society of organizations wey dey observe di 2024 govnorship elections don call on di Independent National Electoral Commission (Inec) to invoke dia powers under Section 65 of di Electoral Act 2022 to review any declarations and returns wia results no dey declared voluntarily or wia di provisions of di electoral act and Inec regulations dey violated.
Di civil organizations under di aegis of di Nigerian Civil Society Situation Room, Yiaga Africa, Kimpact Development Initiative, Nigerian Woment Trust Fund, ElectHer and TAF Africa make dis call afta dem express on top di transparency of di ongoing results collation by Inec.
Di election observer groups wey tok dis one for inside statement dem issue on Sunday, one day afta di Edo state gubernatorial election say dem dey worry about di credibility of di electoral process.
“Reports of disruption for ward and local goment collation centres, plus intimidation of Inec officials and attempts to collate results contrary to di provisions of di electoral act and Inec guidelines, don raise significant concerns about di credibility of di results collation process.”
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
INEC postpone announcement of Edo state govnorship election till 5:00pm
Di Independent National Electoral Commission Inec, don postpone di announcement of di Edo state govnorship election winner until 5pm.
Dis na bicos results of two local government areas, Oredo and Ikpoba-Okha local goment areas neva land sake of say dem still dey collate am.
Di Returning Officer, professor Farouk Musa Adamu say na until di local goment finish dia collation, na im dem go begin announcement again and declare di winner of di election.
Inec don already announce results from 16 out of di 18 local goments areas for di state for di Inec collation centre for Benin city.