On Tuesday, lawmakers for Nigeria House of Representatives elect Femi Gbajabiamila as di speaker of dia from 2019 to 2023.
Abdulmumin Jibrin, nominate Di former Majority Leader of di eight House of Representatives wey dey represent Surulere constituency and im go up against Umar Bago wey also dey im party.
Di candidate of di All Progressives Congress (APC) get 281 votes to defeat Umaru Bago wey contest against am. Oga Bago get 76 votes.
Gbajabiamila declare im intention to be speaker for March wit di support of im party.
Who be Femi Gbajabiamila?
Dem born am on 25 June 1962 and oga Gbajabiamila na lawyer wey come from Lagos State.
For 1984, dem call am to di Nigerian Bar afta im graduate from University of Lagos for 1983 wit law degree.
Im work for Bentley Edu & Co, wey be di first law firm for Nigeria before im open im own wey im call Femi Gbaja and Co. Im go America wia im go John Marshall Law School for Atlanta, Georgia and afta im get degree to practice law.
Tori bin comot say dem suspend am from practicing law for di state over magomago accuse but Gbajabiamila say no be true and say im go take legal action on top di tori.
Femi Gbajabiamila enta politics under di platform of Alliance for Democracy (AD).
Im don dey di House of Representatives since 2003 and im dey represent di Surulere Federal Constituency of Lagos State.
For 2011, dem nominate am for National Honour but im turn am down. Im don also push for major bills for di house like di Employee Rights Bill, Central Bank of Nigeria (Amendment) Bill and di Bill for Electric Power Reform Act wey go stop and criminalise estimated billing by Electricity Distribution Companies. Im also head di House of Representatives Committee on Ajaokuta Steel Company Limited.