Trump say dem don rescue US missing crew member wey Iran shoot down dia jet

Wia dis foto come from, Alex Brandon-Pool/Getty Images
- Author, Lyse Doucet
- Role, Chief international correspondent
- Read am in 4 mins
US President Donald Trump don announce say US military forces don rescue di missing American crew member wey Iran shoot down dia fighter jet.
Di president make di announcement on Sunday ontop Truth Social, wia e say dem rescue am on Sunday afta di US military send dozens of aircraft wit lethal weapons to Iran.
Trump tok say e dey safe and sound but e "sustain injuries" and e go dey fine.
"WE GET AM! My fellow Americans, ova di past several hours, di United States Military pull off one of di most daring Search and Rescue Operations for U.S. History," Trump tok.
Trump tok say di missing crew member "one highly respected Colonel" wey "dey behind enemy lines for di treacherous mountains of Iran, as our enemies dey hunt am down" but di fellow US forces "dey monitor im location 24 hours evriday".
E tok say di "miraculous" mission come afta dem rescue "anoda brave pilot" yesterday, but dem no confam am becos dem no wan put di second rescue operation in jeopardy.
Di colonel na one of di two crew members wey eject wen dem hit dia jet on Friday. American forces rescue one airman shortly afta dem shoot di plane, but dem no quick find di colonel.
Trump say dis na di first time in military memory wia dem go rescue two US pilots separately for enemy territory.
How dem take rescue di officer?
Di US and Iran bin dey in a race to locate di missing crew member afta Iran shoot down dia jet ova southern Iran.
Di exact circumstances of di US rescue remain unclear, but one pesin wey dey familiar wit di operation describe am as "huge" combat search and rescue mission for southern Iran.
Di BBC understand say engagement bin dey between di US and Iranian forces during di rescue, and di pilot fit don sustain injury during im initial ejection from di aircraft.
Di rescue of crew members of a downed jet na one of di most complex and time-sensitive operations - known as combat search and rescue (CSAR) - wey di US military and dia allies prepare for.
Di air force units behind CSAR missions include some of di most highly trained and specialised members of di military.
Dem dey often conduct di mission wit helicopters, wey dey fly low ova enemy territory, alongside oda military aircraft wey dey conduct strikes and patrol di area.
Trump say US military send dozens of aircraft into Iran and claim say dem carry out di operation witout any death or injury on di part of US.
Iranian state media bin report say troops from di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) bin shoot down one US drone while e dey search for di missing airman.
Di American drone bin crash for Iran southern Isfahan province, di IRGC public relations office dey quoted as saying, according to di semi-official Fars news agency.
Iran bin offer $66,000 reward to capture di colonel

Wia dis foto come from, Miguel J. Rodriguez Carrillo / AFP via Getty Images
On Saturday, US and Iranian forces bin search for di colonel, and Iranian officials inside di kontri bin urge citizens to find am "alive".
Di Iranian officials bin offer reward of £50,000 ($66,100) to capture am, state media tok.
Iran say dem bin shoot down second US warplane ova di Gulf - US media report say dem shoot down one A-10 Warthog shot during a search-and-rescue mission for di first first aircraft wey dem fall.
Di pilot of di Warthog reportedly eject ova di Gulf and dem bin rescue am.
Elsewhere, Israel say dem don carry out new series of attacks on "key infrastructure" for Tehran.
For Israel, emergency services say one pesin wound from shrapnel afta one missile attack from Iran bin dey intercepted.










