NYSC investigate 24-year-old corps member death as family demand justice

Wia dis foto come from, Family
- Author, Adebola Ajayi
- Role, Journalist
- Reporting from, Lagos
- Read am in 5 mins
Di management of National Youth Service Corps (NYSC) don extend dia condolences to di family of Abdulsamad Jamiu wey die during military operation for Shagari Estate, Abuja, on Saturday.
On Saturday, reports bin spread say di Nigerian Army allegedly kill corps member Jamiu for im family residence for Abuja.
Di Nigeria army on Sunday tok say Samad die during "crossfire" afta dem quickly respond to one distress call for dia area about robbery attack, but di Jamiu family dey demand justice from di Nigeria Army, claiming say dem shoot am "for head" inside im room.
Inside one statement wey NYSC management sign on Monday, di scheme say dem dey work wit relevant security agencies to find out di full story around di incident.
NYSC tok say dem go continue to strengthen efforts wit security and intelligence agencies to reduce risk and improve protection for corps members nationwide.
"While dis occurrence dey deeply regrettable, di Scheme dey reaffirm im commitment to di safety, security, and welfare of all Corps Members and staff across di kontri," di statement tok.
"Di NYSC dey stand wit di family wey dey mourn during dis hard time and dey pray for di peaceful rest of di soul of di deceased."
Jamiu family demand justices as sister narrate dia ordeal
Meanwhile, Jamiu family dey demand justice ova di death of dia 24-year-old son wey die for dia family house in Abuja, afta narrating dia ordeal to BBC News Pidgin.
Di tok-tok pesin to di Headquarters Guards Brigade for Abuja, Olawuyi Odunola on Sunday say Jamiu die for "crossfire" wey happun for im neighbourhood afta dem receive distress call about robbery attack early mor-mor on Saturday, 25 April for Shagari Estate, Dei-Dei, Abuja.
Di army tok say dem respond quickly to di distress call and upon dia arrival for di area di troops begin exchange gunfire wit di armed robbers as dem dey run away.
Di army say dem don "initiate thorough investigation to fully ascertain di circumstances surrounding di incident".
While Jamiu family tell BBC News Pidgin say di army visit dia residence and allegedly shoot Jamiu for im head wia e die instantly inside im room wia e dey sleep.
Videos and fotos wey dem show BBC News Pidgin claiming to be di aftermath of di army visit, show scattered areas for di room and di door and walls wey bullet holes dey.
Fareedah Jamiu, sister to di deceased wey follow BBC News Pidgin tok, say na "pure lies" and her broda no die during any robbery "crossfire" for dia neighbourhood rather na "men in uniform" kill her broda wia e dey sleep inside im room.
She tok say she di incident bin happun around 2:00 am on Saturday, wen she bin dey sleep for her room upstairs, bifor she hear gunshots and quickly go lock di door.
Fareedah say as she reach downstairs na "uniform men" she see for dia apartment and den she ask dem about her broda.
She tok say wen she no see am, na so she enta im room wia she see im bodi lifeless and begin "scream" out of shock.
"I dey sleep upstairs and im room dey downstairs, wen I hear gunshots. I wake up and quickly lock di door.
"I go im room to go stay wit am, den I kon see some men for uniform. I come kneel down begin beg dem, make dem no harm me," she tok.
"So, dem ask me who I be, I tell dem say I be di resident of dis house. I tell dem say if I come down make dem no shoot. As I come down, I begin smell gunshots and I ask wia my broda?"
She add: "Di gunshots wey I hear na my broda dem kill for inside im room, I begin scream ova im death. Den, one of di sojas say why I dey shout, make I no wake di neighbours."
She tok say afta di incident, di military officers call di police and vigilantes for dia area.
She tok say dem hand ova her broda lifeless bodi to di police and den ask di vigilante make dem clean di blood wey don spread for floor.
To corroborate wetin Fareedah tok, Jamiu family issue on statement on Monday, wia dem dey demand for justices ova di death Samad.
Di family claim say di statement from di Nigeria Army on Sunday say Samad die during "crossfire" na lie.
Jamiu family tok say Samad die through firearm exchange from close range wey pass through di "door of Abdulsamad room", di bullet strike Samad Jamiu for "head, e kill am instantly."
Di family demand say make di army conduct full investigation witout any interference of di Nigeria Army.
Jamiu family tok say dem want immediate identification and suspension of di officers wey dey involved for di death of Samad.
Di family also demand make di Nigeria Army tender apology to di Jamiu family publicly, pull down di statement and give real account wit "physical evidence and di military prior admission."
"Immediate, independent, and clear investigation about how Abdulsamad Jamiu die, make dem conduct am outside di chain of command of di Nigerian Military and make civilian supervise am," di statement tok.
Di family add: "Di identification, suspension pending di investigation, and prosecute dose wey dey directly responsible for discharging di weapon wey kill Abdulsamad Jamiu,"
Nigeria Army order thorough investigation into di incident
Di Headquarters Guards Brigade on Sunday inside dia statement tok say dem don initiate thorough investigation to fully ascertain di circumstances wey surround di incident.
Dem tok say dia findings go dey available publicly wen e ready while dem dey committed to transparency and accountability.
Di army tok say dem don handover di remains of di deceased to di appropriate civil authorities and dem don deposit am for Kubwa General Hospital.
"Guards Brigade dey affirm di unwavering commitment to di protection of lives and property within di Federal Capital Territory. We go continue to review our operational procedure to improve civilian safety, even as our troops dey confront di criminal elements wey dey threaten di peace of our communities," di statement tok.
"We dey urge di members of di public make dem remain calm and continue to cooperate wit security agencies as we work to maintain safety and security."










