Outcome of PDP national convention as Mohammed, Anyanwu emerge as chairman, secretary

Read am in 4 mins

One group of Nigeria opposition Peoples Democratic Party (PDP) wey di Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike dey support don elect Abdulrahman Mohammed and Samuel Anyanwu as substantive National Chairman and National Secretary of di party through consensus arrangement wey di party adopt.

Ova 2,000 delegates from across di 36 states and di Federal Capital Territory (FCT) bin endorse Mohammed and Anyawu and 19 oda members of di National Working Committee (NWC) of di party for dia own national convention for velodrome of di Moshood Abiola Stadium for Abuja, Nigeria capital on Sunday.

Oda prominent party members wey attend di convention na one former govnor of Jigawa State Sule Lamido, former Senate president Bukola Saraki and one former Kaduna State govnor, Ahmed Makarfi, among odas.

PDP dey divided into two groups – one wey FCT Minister Nyesom Wike dey lead and di oda one wey Oyo State govnor Seyi Makinde dey control.

Di Wike group bin hold dia convention, despite say di oda faction don carry dia mata go Supreme Court.

Wetin Wike tok

Minister of di FCT Nyesom Wike, wey dey identified as di national leader of di party, tok say healing for di PDP don start.

E assure im members say PDP go dey di ballot for di 2027 general elections.

"So many pipo hia don tok, Saraki, Abba Moro don tok. Dem dey ask, 'PDP go contest di 2027 election so?'

"don tell Senator Saraki say by di grace of God, the PDP go dey on di ballot for 2027. We don see di real convention, di convention wey di electoral umpire monitor. Dat na di convention wey dem recognise," delegates hail am as e dey tok.

E say dem must build di future of di party inclusiveness, wit equal opportunity for party members.

E hail di delegates for demonstrating good character.

Di former Rivers State govnor also say di party go recover dia mandate from dos wey collect am.

Earlier, wen e dey inspect di venue of di Sunday event, Wike say dem go kontinu to reconcile di different factions of di party.

"Chance dey for accommodation. Di PDP na very large party. Look di umbrella, e dey wide enof to accommodate evri one."

On di appeal by Kabiru Turaki bifor di Supreme Court, Wike say e no go affect di convention.

"We don already zone our positions. Evri zone get im own slot. We don zone di presidency to du South, while di chairmanship dey go North. We believe say dis consensus arrangement go make di process easier."

'Unity ova division'

Mohammed tok say di party go belong to all members under im leadership.

Earlier, e call on members to embrace inclusiveness as di party reposition well for di 2027 general elections.

"Today, we choose a higher path. We choose inclusiveness ova exclusion, unity over division, we choose renewal ova decline. Mohammed tok.

"Distinguished delegates, dis no be official day. Today na moment of reflection, moment of responsibility, and above all, moment of renewal. We gada hia afta difficult session, session of disagreement, legal contestation, session wey test di strength and soul of dis party," e add.

States divide weda to attend or not

E dey clear say PDP don really divide sake of wetin dey happun for many states.

While states like Edo, Kebbi and di rest say dem no go involve dia sef for di convention, odas including Rivers, Kwara, Osogbo and so on say dem stand gidigba wit Wike.

Already, Ini Ememobong wey be di National Publicity Secretary of di party wey di govnors dey support say dem no get hand for di convention.

"Our leaders, govnors, members of BoT, members of di National Executive Committee and others no go attend di convention," e tok.