Presidency defend why Tinubu console Plateau attacks victims for Jos airport afta dragging

Tinubu with families of Plateau attacks victims

Wia dis foto come from, @aonanuga1956/X

Read am in 4 mins

Nigeria Presidency don defend President Bola Tinubu decision to meet victims of di Plateau State killings for one adjoining hall for di Yakubu Gowon Airport instead of make e drive into Jos township.

Bayo Onanuga wey be di Special Adviser to di President on Information and Strategy tok for inside one statement say na logistic issue cause am.

Di statement from di Presidency dey come afta Nigerians drag di president say e bin meet wit di victims for airport.

"While di road distance from di airport to Jos township dey approximately 40 minutes, di runway no support night flights sake of di absence of navigational aids," Onanuga tok.

Onanuga say di challenges make am impossible to drive into town, meet victims for on-di-spot assessment and return to di airport bifor dusk.

"Consequently, state and federal officials bin decide to bring representatives of di affected community to one hall wey adjoin di airport so di President go fit meet wit dem promptly while adhering to flight restriction," Onanuga tok.

President Tinubu bin go Jos on Thursday 2 April to commiserate wit di families of pipo wey lose dia lives for di attacks wey happun on Palm Sunday and Wednesday 1 April.

Di deadly attack wey happun on Sunday 29 March for di Gari Ya Waye community of Angwan Rukuba kpai ova 20 pipo and injure several odas.

Di Commissioner for Information and Communication, Rt Hon Joyce Lohya Ramnap, say di govment condemn di "barbaric and unprovoked attack on innocent citizens".

Di Plateau State Govment bin impose 48 hours curfew on Jos North Local Govment Area afta di deadly attack for di Gari Ya Waye community of Angwan Rukuba.

Rt Hon Joyce Lohya Ramnap wey be di Commissioner for Information and Communication, say di govment condemn di "barbaric and unprovoked attack on innocent citizens".

Di curfew bin take effect from Sunday midnight and last till Wednesday 1 April.

Afta di end of di curfew, anoda violence happun on Wednesday for some areas for Jos metropolis as local tori pipo say at least one pesin bin kpai and panic spread for several neighbourhoods for Jos North.

"In moments of grief, we gatz stand togeda. In moments of progress, we gatz keep building. Di work continue. Nigeria First," President Tinubu tok for im tweet on X.

Tinubu receive Plateau State govnor for Presidential Villa, police arrest suspects

Tinubu and Mutfwang

Wia dis foto come from, @aonanuga1956/X

Bifor im announcement say im go visit Plateau State, President Tinubu on Wednesday bin receive di state Govnor Caleb Mutfwang, for di Presidential Villa for Abuja.

Di meeting bin focus on immediate security measures to prevent further attacks for Plateau State.

On Wednesday, di Plateau State Command of di Nigeria Police Force confam say dem gbab one suspected fake soldier and five odas in connection wit di tension wey rock parts of Jos on dat day.

Di Police Public Relations Officer, Alfred Alabo, say di suspect, wey bin wear army singlet and one extra shirt, chop arrest for Angwan Rukuba, di same community wia several pipo kpai and injure on Palm Sunday.

E say dem gbab di suspect as e dey roam suspiciously for di area on Wednesday afternoon and dem find fake Nigerian Military School (NMS) identity card for im hand.

Alabo describe di five odas wey dem gbab as hoodlums wey bin exploit di situation to engage in criminal acts.

Unijos order emergency evacuation of students

Di management of di University of Jos on Wednesday direct dia students to vacate dia hostels sake of security concerns for parts of Jos.

Tanko Ishaya wey be di Vice Chancellor order di immediate evacuation of students from hostels as precautionary measure.

Na di Deputy Registrar, Information and Public Relations, Emmanuel Madugu, give di informate inside one statement.

"Di Vice Chancellor don direct di immediate evacuation of students from di university hostels in view of di general security situation and di near chaotic scenarios witnessed in areas wey dey close to di university," di statement tok.