Wetin we know about airstrike wey hit market, kill many traders between Borno-Yobe border

Wia dis foto come from, Getty Images/Adu Marte
Many pipo don die afta Nigerian military jets strike one village market.
Tori be say di strike happun as military dey pursue Islamist militants for Yobe state, northeast Nigeria on Saturday night, one councillor for di area and residents tell Reuters.
Nigeria Air Force confam to Reuters News say dem kill Boko Haram militants for di Jilli axis for Borno state, but for di statement dem release to Reuters on Sunday, dem no mention say dem hit any market.
Di Yobe State Emergency Management Agency don confam di deaths for Jilli Market, Gubio LGA of Borno State wey share boundary wit Geidam LGA Yobe State – but dem no give di number of pipo wey die.
"We don receive preliminary reports of one incident dis morning for Jilli Market for Gubio Local Government Area Borno State wey border Geidam LGA Yobe State. wey reportedly result in casualties wey affect some marketers from Geidam LGA Yobe State."
Di agency add say dem dey monitor di situation and dem dey put evri effort to establish di facts and ensure say dem provide appropriate humanitarian assistance.
Di strike happun for one village for Yobe on di border wit Borno, di heartland of one long-running insurgency wey don kill thousands of pipo and displace millions more.
Lawan Zanna Nur Geidam, di councillor and traditional head of Fuchimeram ward for Yobe Geidam district tell Reuters say dem don carry pipo wey injure go hospitals for Yobe and Borno.
"Na very devastating incident for Jilli Market. As I dey follow you tok now, ova 200 pipo don die from di air strike for di market," e tok for one telephone interview.
Three oda residents plus official from one international humanitarian agency also confam di strike and likely death toll.
Ahmed Ali, one 43-year-old resident wey dey sell medical consumables for di market, say im injure from di blast.
"I fear and try to run, but my friend drag me and lie down for ground," e tok from hospital.
Amnesty International Nigeria don condemn di military airstrikes wey dem say kill ova 100 pipo for Jalli Futchimiram.
"Launching air raids no be legitimate law enforcement method by anyone standard. Such reckless use of deadly force dey unlawful, outrageous and e lay bare di Nigerian military shocking disregard for di lives of dos dem supposedly exist to protect," di agency tok for statement.
Dem add say Nigerian authorities must immediately and impartially investigate di incident and ensure say suspected perpetrators face di music.









