‘Inec dey behave like criminal, di oga dey support Tinubu but we no go gree’
Na less dan a year to di election and di African Democratic Party, ADC, wey big weights like Peter Obi, Atiku Abubakar and odas join, form coalition to fight APC and President Bola Tinubu leg don dey shake seriously.
As e be so, di Independent National Electoral Commission, Inec don say dem no go recognise di David Mark leadership of di ADC after one case wey di former Deputy National Chairman Nafiu Bala, carry go court over who be di rightful national chairman of di party.
For dis exclusive interview wit BBC News Pidgin, di National Publicity Secretary of ADC tok about who dem tink say dey behind dia palava, why and di options before dem.
Dis dey come even as oda parties wey for fit face di ruling APC and Tinubu too get controversies wey fit no allow dem see road for di 2027 election.



