Catholics for Nigeria don gada to do 'March for Life'

Catholic faithful don enta road for different parts of Nigeria for di peaceful protest wey dem dey do today on top di killi-killi of dia members and oda Nigerians.

Dia protest dey come as dem dey bury di two catholic priests wey suspected herdsmen kill for St. Ignatius Catholic Parish inside Ayar Mbalom for Gwer East Local Government Area of Benue State about a month ago.

Catholic Bishops Conference of Nigeria (CBCN) bin give order to all Catholic faithful all over Nigeria to come out and do peaceful and prayerful protest, wey dem title 'March for Life,' on Tuesday to let goment know say dem no dey happy for wetin happen.

Already, Benue state Governor, Samuel Ortom don declare Tuesday as work-free day to honour those wey die.
BBC News Pidgin tori pesin for Nigeria capital, Abuja, Dooshima Abu, report say Catholics for dia no care about di early morning rain, dem still come out plenti to do di protest.
Dem first gada for di National Ecumenical Centre before dem go enta street and hold service take honour those wey die.
For Port Harcourt, Karina Igonikon, dey follow di protest and she tok say dem begin di mass first before dem come waka enta road in solidarity with di all those wey suspected herdsmen don kill.
Di Catholic Bishop of Port Harcourt-Camilus Etokudoh remind everi bodi say life dey sacred and also condemn di killi-killi of pipo.
End of Di one wey oda users dey read well well
E say di peaceful protest march no dey political and dis no be time to do politics with di death of pipo:
"Herdsmen don take ove many of our land across di kontri and we go continue to petition president Buhari to come chok mouth solve dis mata."


Meanwhile, BBC tori pesin for Lagos- Andrew Gift report say di Catholic Archbishop of Lagos-Most Rev. Alfred Adewale Martins call goment to solve dis palava before e go lead to anoda ethnic clash.












