2027 Elections: Wetin political parties for Nigeria dey do to comply wit Inec regulations

Wia dis foto come from, APC Nigeria/X
All di major political parties for Nigeria don start activities for top gear, preparing for di 2027 general elections wey go hold between January 16 and February 6, 2027.
Weda na di ruling All Progressives Congress (APC), abi na di join bodi opposition coalition party, di African Democratic Congress (ADC), or even di former ruling Peoples Democratic Party (PDP) wey now dey struggle for survival, all of dem don enta election mode proper.
Dis tori na summary of all di activities wey di different political parties dey carry out as dem dey try to meet di revised election timetable wey di Independent National Electoral Commission (Inec) bin release in February.
APC ready for National convention
Di ruling APC don dey set for dia National Cogress wey dem schedule to hold on Friday and Saturday, 27 and 28 March 2026.
Di party on Wednesday conclude dia zonal congresses across di six geo-political zones of Nigeria, wia dem elect new leaders for dose levels.
For di zonal congresses, dem adopt di consensus method of election wia leaders don already dey selected but di congress go now affirm dem using a voice vote.
Di Southwest zonal congress produce Dr Isaacs Kekemeke wey dem re-elect as zonal chairman and automatically di National Vice Chairman for South-West.
For di South-South zone, di congress hold for Asaba, Delta State, and Victor Giadom emerge as chairman. Di Southeast congress produce Dr Ijeoma Arodiogbu as Chairman, while for di Northwest, di new chairman na Garba Babao.
Idris Shuaibu win di chairman for di APC Northeast zone, while di Secretary to the Govment of di Federation, George Akume, na im also be di leader of di APC for di North-central zone.
All dis leaders plus dia exco members na tru consensus dem emerge as di APC say e dey in line wit di new electoral act wey Presido Bola Tinubu sign into law recently.
"Today, we don see di conduct of free and fair election, following di provisions of di 2026 Electoral Act. Dis congress show say di South-West dey united and na formidable political bloc," Lagos State guvnor Babajide Sanwoolu tok for di Southwest congress.
Section 84(2) of di new electoral act tok say: "Di procedure for di nomination of candidates by. political parties for di various elective positions go be by direct primaries or consensus."

Wia dis foto come from, APC
PDP wan reconcile ahead of dia congresses
Di PDP still dey try to recover from di recent judgement by di Court of Appeal wey nullify di national congress wey a faction of di party bin hold last year for Ibadan, Oyo State.
Afta dis judgement, di PDP bicom weaker as on of dia govnors, Dauda Lawal of Zamfara State, comot from di party go join APC.
Now, di PDP faction led by Tanimu Turaki who di appeal court bin nullify im election as national chairman, don approach di faction wey dey headed by di Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, for dem to make peace.
Dis dey come as di Wike faction bin don set new date for dia national congress to be on March 29 and 30, just one day afta di APC own.
Turaki tell tori pipo on Tuesday say: "I fit confam say, as of today, leaders for both sides don break di ice and we dey explore various pathways towards a lasting resolution."
"We get confidence say we fit still work togeda and dis reconciliation go work. In life, e get times to fight, and e also get time to make peace."
Turaki assure PDP members wey neva jump comot from di party say make dem no fear as dem go do evritin possible to make sure say di party go bring out candidates for di 2027 election.
Meanwhile, di FCT Minister also tell tori pipo say PDP no dey divided even though e get pipo wey no dey happy for inside di party.
Wike also confam say reconciliation tok dey go on even as di planning for di national convention also dey go on.
ADC national convention on 14 April
Di Africa Democratic Congress, wey don come out as di leading opposition political party for Nigeria, hold dia National Executive Council (NEC) meeting on Tuesday, wia dem agree dates for dia congresses for di various local govments and States ahead of dia national congress.
According to di ADC tok-tok pesin Bolaji Abdullahi, di ward congressesgo hold on 7 April, di LG own na 9 April, di state own na on 11 April, while dia national convention go be for Abuja on 14 April, 2026.
Di national convention no go be for election of party officers or for primary election, according to explanation wey oga Bolaji give tori pipo. E go be just to ratify di major decisions wey di NEC and di National Working Commission (NWC) bin don make.
LP zone presidential candidate to South
Di Labour Party also don dey ginger diasef ahead of di general election, afta di federal high court for Abuja bin settle di leadership wahala wey almost tear di party apart.
Dat leadership tussle make di party presidential candidate for di 2023 general election, Peter Obi, dump dem and join di ADC.
Also many elected officials of LP follow Obi enta APC, including three senators: Ireti Kingigbe of di FCT, Victor Umeh of Anambra Central, and Tony Nwoye of Anambra North.
However, di party retain dia one guvnor wey be. Alex Otti of Abia State, as well as some federal lawmakers from Abia State.
Currently, di leadership of LP dey for di hand of former Minister Nenadi Usman who di courts recognise as di main leadership.
On Tuesday, afta meeting wit Inec oga dem, Madam Usman tell tori pipo say di party don dey ready di general election, and one ogbonge decision wey dem don make na to zone dia presidential ticket to di southern region of Nigeria.
She say: "We certainly no go field any aspirant from Northern Nigeria. We don zone di position to Southern Nigeria. Wen di aspirants come, whoeva di pipo like and vote for during di primaries go emerge as di candidate."
Di party bin fix dia national convetion to be dis Thursday, 26 March, but dem later postpone am sake of say dem wan give more of dia members opportunity to participate for dia ongoing online membership re-registration exercise.
Dem neva tok di new date wen di national convention go hold.
APGA adopt Tinubu
For di All Progressives Grand Alliance (Apga) dia national chairman, Sly Ezeokenwa, tok for TV interview on Wednesday say di party don agree to adopt Presido Tinubu as dia candidate for 2027.
Bifor now, di Anambra State guvnor Chukwuma Soludo, wey be di only APGA guvnor, don also tok say dia party go support di sitting president.
"Even bifor anybody declare interest, di party maintain di position say we go stand ideologically aligned wit not just di All Progressives Congress, but wit di 'Renewed Hope' agenda of Mr President," Ezeokenwa tok.










