Nigeria collect wotowoto for Portugal hand

Nigeria no show class for di game

Wia dis foto come from, Getty Images

P ortugal dey go Qatar 2022 Fifa World Cup wit plenty confidence afta thrashing Nigeria 4-0.

Two goals from Bruno Fernandes and one each from Ramos and Mario give di Selecia dia well-deserved victory.

N igeria bin get chance to enta di game back for di 78th minute with a penalty kick - but Emmanuel Dennis miss am.

Di Super Eagles bin no play well for di first half. Na for di second half dem find dia groove wit di substitution of some players.

T hursday night display of di Super Ealges summarise di poor run throughout dis year.

D em don lose five of dia matches dis year - both comeptitev and non-competitive.

D is na di first time Portugal dey play Nigeria and dem go happy wit dia first experience.

F ULL TIME P ortugal 4-0 Nigeria

S econd Half

90mins: Two minutes of time added on for Portuguese capital.

8 8mins: Dis na Nigeria almost get cause comedy of an own goal. Uzoho wey bin dey slow try stop di call from crossing di line.

84mins: GOAL! Portugal 4-0 Nigeria - Joao Mário make am four!

8 3mins: GOAL. Ramos score on im debut for Portugal

7 8mins: PENALTY for Nigeria. Emmanuel Dennis miss di penalty

7 8mins: Corner for Portugal. Dem lose di ball and Nigeria catch dem on counter.

7 6mins: Substitution for Portugal. Horta enta for Octavio

7 5mins: Anoda missed chance by Jao Felix. Im shot go off wide

7 3mins: MISSED CHANCE. Uzoho save Jao Felix shot.

7 2mins: MISSED CHANCE. Patricio save solo shot fromChukwueze. Di ball go corner

7 1mins: Etebolose di ball afta e spend too much time.

6 9mins: Substitution for Nigeria. Etebo enta for Joe Aribo

6 8mins: Fould for Nigeria. No card for di match.

6 6mins: Substitution for Portugal. Ramos enta for Silva. Na di first time Ramos dey play for National team

6 2mins: Free kick for Super Eagles. Mario bring down Simon on di edge. Simon take di free kick but Portugal goalkeeper save am.

6 1mins: Throwing for Nigeria. Moses Simon dey show effort from di left.

6 0mins: From Diogo Dalot to Vitinha, Jao Felixm Portugal attempy yo break Nigeria defence again. Troost-Ekong block di last pass.

5 9mins: Substitution. Onuachu enta for Murphy

5 7mins: Easy catch for Uzoho. Silva bin wan give through pass from di left.

5 5mins: Calvin Bassey det get tough time to move around as im like

5 3mins: Nigeria don dey impressive so far since di second half start unlike wetin dem play for di first part of di game.

51mins: Ramos and Jao Felix dey control Portugal play for midfield.

4 9mins: Antonio Silva block Iwobe pass to Chukwueze. Super Egles bin try move on a counter.

4 6mins: Super Eagles dey try find dia grooove early in di second half

45mins: Substitution for Nigeria. O nyeka enta for Ndidi

C hukwueze enta for Lookman

4 5mins: Substitution for Portugal. Pepe, Vitinha, João Mário and Raphael Guerreiro enta for Rúben Dias, Nuno Mendes, Bernardo Silva and Bruno Fernandes.

H ALF TIME

P ortugal 2-0 Nigeria

45mins: Bruno Fernandes almost score wit a lovely through ball by Joao Félix.

44mins: Nigeria pin Portugal back. This Naija team no go at all.

40mins: Simon take on im man on di left, before slipping di ball inside to Aribo.

38mins: Portugal dey in total and utter control.

35mins: Bruno score di penalty!

Portugal 2-0 Nigeria!

PENALTY! Ref blow penalty kick for Portugal afta Super Eagles defender foul inside box 18.

33mins: Ndidi bring Otávio down some 40 yards out from goal, and Portugal get opportunity to deliver dead ball into di Nigeria box.

31mins: Portugal goalkeeper Rui Patrício dey touch ball for di first time.

Portugal 1-0 Nigeria

27mins: Portugal do neat short-corner routine wey end up wit Mendes cutting di ball back to Carvalho.

Portugal 0-0 Nigeria

26mins: Iwobi pass give Aribo, e no fit take di ball do better tin.

23mins: For di first time Nigeria manage to comot for dia own half

18mins: Portugal get 70% possession. All di game dey happun inside do half of di Super Eagles.

16mins: Bernardo Silva whip low ball into Super Eagles area but e too far.

9mins: GOAL! Bruno Fernandes score for Portugal.

Portugal 1-0 Nigeria

​​​​​​​6mins: Bright Osayi-Samuel dey also m,ake im first appearance for Super Eagles on di right back.

4mins: Portugal dey control di ball inside José Alvalade. Mendes bring di ball forward down di left, before e play am to André Silva.

2mins: Nigeria immediately win corner. Simon take am but dem no handle am well.

1min: Portugal 19-year-old centre-back António Silva dey make im debut for di Seleção

K ICK OFF: F irt Half

Bruno Fernandes score for Portugal

Wia dis foto come from, Getty Images

Portugal vs Nigeria team news

Portugal: Patrício, Dalot, Dias, António Silva, Mendes, Otávio, Bruno Fernandes, Carvalho, João Félix, André Silva, Bernardo Silva​​​​​​​.

Nigeria: Uzoho, Osayi-Samuel, Akpoguma, Troost-Ekong, Bassey, Ndidi, Lookman, Aribo, Iwobi, Simon, Moffi.