Colombian Air Force plane crash wit plenty sojas inside

This screen grab shows soldiers and rescuers near an Air Force Hercules emitting thick smoke after the aircraft crashed during takeoff in Puerto Leguizamo, Colombia, near the southern border with Ecuador, on March 23, 2026.

Wia dis foto come from, Daniel Ortiz / AFP via Getty Images

Read am in 3 mins

One Colombian Air Force plane don crash for di south of di kontri near di border wit Peru.

Colombian military officials say around 80 sojas bin dey inside di aircraft at di time of di accident.

Di plane, wey be Hercules wey dem dey use to transport troops, bin come down near di town of Puerto Leguízamo, for Putumayo province.

Dem don dispatch rescue workers to di area, and Reuters news agency quote two military sources wey say dem rescue 71 pipo alive from di wreckage.

Colombia defence minister, Pedro Sánchez, say di plane bin suffer "tragic accident wen e dey take off from Puerto Leguízamo, transporting troops of our security forces".

E say di exact number of victims neva dey known but describe di incident as "deeply sad for di kontri".

Images shared by local media show smoke dey rise from di site and trucks wey dey carry sojas dey head to di area.

Footage on local news sites also appear to show locals dey transport wetin be like injured sojas from di accident site to hospitals on di back of small motorbikes.

President Gustavo Petro write on X say e "hope say we no go get fatalities for dis horrendous accident wey no suppose happun".

Inside di long post, e also blame "bureaucratic problems" for holding up im plans to modernise di armed forces equipment and dia aircraft.

"I no go allow further delays, di lives of our young pipo dey at stake," e write witout clarifying wetin fit cause di accident.

Last month, one Bolivian Air Force C-130 Hercules wey dey transport banknotes bin crash for di west of di kontri and kpai at least 20 pipo.

Earlier, BBC News Pidgin bin report say two pilots die afta one passenger plane jam one fire truck for LaGuardia Airport for New York.

Fotos from di scene show as di plane backwards and di cockpit almost comot for di bodi.

Debris, wreckage and warped metal full di bodi of di fire truck wey stand near am.

Authorities tok say dem don carry 41 pipo go hospital, dem later discharge 31 passengers but some suffer from serious injuries.