Watkins late goal set up Spain vs England epic Euro 2024 final

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Three Lions of England don qualify for di final of di ongoing Euro 2024 championship.
England beat Netherlands 2-1 to qualify for dia second back to back final.
Netherlands open scoring for di first half in di 7th minute through Xavi Simons.
E no tey bifor Denzel Dumfries commit foul as e bring down Harry Kane inside di box.
Referee award penalty to England and Harry Kane score di penalty to draw level for di 18th minute.
Plenti action full di match for di first half.
Second half start wit more action wey see England hold possession of di ball well well.
But England get beta chance wey dem convert for added time of second half.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ollie Watkins put di ball inside di net afta Cole Palmer give am beta pass.
Di late goal break di hearts of Netherlands and England celebrate dia victory.
England go jam Spain for di final on Sunday.

Wia dis foto come from, Getty Images
Second Half
Full Time Netherlands 1-2 England
England don qualify for di final!
90+6 Match don end!
90+3 Substitution for Netherlands Xavi Dimmons don comot Brian Bobbey replace am.
90+3 Substitutions Busayo Saka don comot Ezri enta for am.
90+ 1 Xavi Simmons chop yellow card Netherlands 1-2 England
90 +1ā GOAL! Ollie Watkins of England score! Di goal come afta Cole Palmer send di pass to Ollie Watkins wey play di ball into di bottom left corner of di post.
87ā Virgil van Dijk of Netherlands collect yellow card too for foul.
86ā Bukayo Saka chop yellow card for di foul.
86ā Bukayo Saka of England bring down im opponent, referee blow whistle and give Netherlands free kick.
85ā Denzel Dumfries of Netherlands drag di shirt of im opponent, referee blow whistle, free kick for England 81ā Substitution for England, Cole Palmer don enta for Phil Foden. Harry Kane too don comot Ollie Watkins enta.
79ā Bukayo Saka of England put di ball for back of di net but na offside according to di linesman.
78ā Xavi Simmons of Netherlands near di edge of di box , e fire shot but e go o top of di net.
77ā Nathan Ake of Netherlands play one dangerous cross but England defebce block am.
74ā One thru ball from Xavi Simmons of Netherlands fail no reach Cody Gakpo as one of di defenders block di ball sharply.
72ā Jude Bellingham of England Donn collect yellow card sake of bad challenge on im opponen.
70ā Declan Rice of England chip di ball into di box but Bart Verbruggen block di ball sharp sharp.
69ā Netherlands get corner kick.
65ā Netherlands get corner kick and Joey Veerman play am towards goal, Denzel Dumfries play head do ball over di bar!
65ā Virgil van Dijk of Netherlands connect wit do ball for di six yard box afta di free kick wey Netherlands play, im shoot towards di right corner of goal, but Jordan Pickford save di ball.
64ā Marc Guehi of England do one yeye foul and refwere blow whistle . Netherlands get free kick.
62ā Phil Foden of England drag di shirt of im opponent but referee forgive am.
61ā Joey Veerman of Netherlands cross di ball into di penalty area but e no dey accurate enough. Di ball go out of play.
60ā Finally England lose possession of di ball as e go out of play.
59ā England still hold ball o, Netherlands just dey run follow dem upandan.
57ā England still hold ball and dem dey make short short passes wey dey sweet di belle of di English fans.
54ā Xavi Simmons of Netherlands make one solo run but im no fit create beta chance as England player block di ball. Di ball go out of play.
51ā Marc Guehi of England pass long ball to Luke Shaw but do Netherlands defence clear di ball.
49ā Bukayo Saka of England send one pass into di box but defenders clear di attemp.
48ā Dem clear di ball afta Jude Bellingham of England try to dribble im opponent , d ball comot from field and na goal kick for Netherlands.
46ā Substitution for Netherlands, Donyell Malen don comot as Wout Weghorst replace am.
46ā Substitution for England Luke Shaw don enta for Kieran Trippier.
46ā Referee Felix Zwayer don blow whistle, second half don start.
First Half

Wia dis foto come from, Getty Images
Netherlands 1-1 England
45+4 Referee blow whistle, first half don end.
45+2 Netherlands hold possession of di ball as dem dey play short short passes to try create last minute chance.
45ā Fourth official show three minutes of added time.
45ā England dey play short short passes to hold di ball and drag Netherlands out.
44ā Jude Bellingham of England try to send one pass but dem block am.
41ā Kobbie Mainoo of England fire shot from di edge of di box, but di shot no disturb di goalkeeper as defender block di shot.
39ā Phil Foden of England get one pass e make effort from di edge of di box, but Bart Verbruggen of Netherlands go down di right to clear di ball.
37ā Jude Bellingham of England run pass all do defenders inside di box but im pass to Kieran Trippier too fast, di ball roll comot from touchline.
35ā Substitution for Netherlands, Memphis Depay no go fit play again sake of injury, Joey Veerman don replace am.
32ā Phil Foden of England control one beta pass from di edge of di penalty area but Iām shot hit di left post!
30ā Denzel Dumfries of Netherlands fire di corner kick inside di box but im header hit di cross bar.
30ā Xavi Simmons of Netherlands dey prepare to play corner kick.
28ā Jude Bellingham of England get one beta pass from Phil Foden but dem stop di ball.
25ā Kyle Walker of England play one quick thru ball to wia im teammates dey, but im dey close to di offside line, one of di defenders block di ball.
23ā Phil Foden of England fire shot from inside di box afta Iām dribble some defenders, e beat di goalkeeper too but hit one of di defenders and di ball bounce comot.
21ā England dey hold ball well well now
Netherlands 1-1 England
18ā GOAL! Harry Kane score di penalt!
17ā PENALTY for England! dis dey come afta dem bring Harry Kane down inside di box.
17ā Denzel Dumfries of Netherlands collect yellow card for foul.
15ā Referee dey go check VAR for possible penalty.
14ā Harry Kane of England fall inside di box afta one challenge from defender but referee wave hand for game to continue.
14ā Bukayo Saka fire di ball towards goal for inside di area but defenders block am.
11ā Phil Foden of England play one free kick into di box but dem clear am.
Netherland 1-0 England
7ā GOAL! Xavi Simmons score for Netherlands, e strike di ball into collect corner of di net.
5ā Bukayo Saka of England send one cross into di box but dem use head clear am out.
3ā Poor challenge from Jerdey Schouten of Netherlands, refer punish am as e give England free kick.
2ā Donyell Malen of Netherlands dey offside position , ref stop play afta linesman raise im flag.
1ā Referee Felix Zwayer don blow whistle and match don start.
Netherlands go face England for di semi-finals of di ongoing Euros. Dis na England second semi finals back to back for di Euros.
England performance improve against Switzerland for di quarter-finals wey make dem progress to di semi finals on penalties.
Even though Gareth Southgate side don show say dem ready come dis tournment, dem dey always put diasef for tight corner.
Netherland too no be small team - dem qualify for di semi finals afta dem beat Turkey 2-1.














