Key tins wey happun since protesters storm Sri Lanka president house

"Sri Lanka president Gotabaya Rajapaksa": Four tins wey happun since protest

Wia dis foto come from, Getty Images

Sri Lankan speaker of parliament say dem go elect new president in nine days time.

But dat na if President Gotabaya Rajapaksa do as e promise to resign, di speaker tok.

Meanwhile president Rajapaksa whereabout still dey unknown.

Speaker Mahinda Yapa Abeywardena say e bin mis-yarn wen e say di president leave di kontri.

Saturday historic protests for Sri Lanka, wey appear to make both di president and di prime minister to resign, na "huge show of willpower by di public".

Na wetin demonstrator Catherine Mack tell BBC News.

And tins dey happun fast since Sri Lanka protesters force dia way enta one of di most protected building for di kontri.

Massive crowd of frustrated and angry kontri pipo, force dia way enta di official house of President Gotabaya Rajapaksa official house for Colombo on Saturday.

Dem dey protest ova di economic crisis wey di kontri dey face.

As events dey unfold, dis na four main tins wey don happun so far.

"Sri Lanka president Gotabaya Rajapaksa": Four tins wey happun since protest

Wia dis foto come from, Getty Images

1. Fuel supply don resume

Limited supply of fuel and gas don resume for some parts of Sri Lanka.

Long queues don form for filling stations and community centres across di kontri capital, Colombo on Monday.

Fuels supply dey come for di city afta months of shortage of fuel, food and oda basic necessities.

2. Continue to occupy

 "Sri Lanka president Gotabaya Rajapaksa": Four tins wey happun since protest
Wetin we call dis foto, Sri Lanka pipo dey do selfie inside di presidential palace

Protesters bin tok say, dem go continue to occupy di Sri Lanka president and prime minister house until di two leaders officially resign.

Thousands of men, women and children dey wanda from room to room, everybody way do selfie in front of different tins inside di house.

Sri Lankan pipo feel say dia many months of protest don finally lad to di removal of dia kontri leaders, wey dem blame for di economic palava.

As dem see small of dia di lifestyle of dia leaders e make dem even more angry.

3. President Rajapaksa confam resignation

Sri Lanka president profile graphic

Sri Lankan President Gotabaya Rajapaksa don confam on Monday say im go resign.

Na im Prime Minister, Ranil Wickremesinghe wey dey plan to step down confam Rajapaksa resignation.

Di parliament Speaker bin tok earlier say di president go resign on 13 July.

President Rajapaksa never dey seen

"Sri Lanka president Gotabaya Rajapaksa": Four tins wey happun since protest

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, President Gotabaya Rajapaksa

E no too clear wia President Rajapaksa run go as protesters force dia way enta di im official house.

Military sources tell BBC say im dey for one navy ship for Sri Lankan waters.

Tori be say dem move am to safety before protesters enta presidential palace.

Also former Prime Minister Mahinda Rajapaksa, dey one navy base inside di kontri, di source add.

So far, im neva say pim afta di invasion.