OnlyFans owner Leonid Radvinsky die at di age of 43

Wia dis foto come from, Leonid Radvinsky via his website lr.com
- Author, Natalie Sherman
- Read am in 3 mins
Di owner of OnlyFans don die at di age of 43.
Leonid Radvinsky, wey dem born for Ukraine and grow up for Chicago, bin purchase OnlyFans for 2018 from di two UK-based founders.
OnlyFans dey known for im adult content wey dey credited wit changing di way di online porn industry bin dey operate.
Di site popularity increase during di Covid-19 pandemic, wey bin land Radvinsky on Forbes annual list of billionaires just three years later.
E "pass away peacefully afta long battle wit cancer," OnlyFans tok inside one statement, wey ask for privacy for im family.
OnlyFans, wey dem found for 2016, na one social media platform wia creators fit post videos and fotos and charge subscribers for tips or monthly fee.
Creators dey share different content from cooking to fitness videos, but e dey best known for pornography plus di way e dey encourage creators and fans to connect through livestreams, personalised messages, and direct requests for custom-made fotos and videos.
In return for hosting di material, OnlyFans dey take 20% share of all payments.
Di company generate $1.4bn in revenue from more dan £7bn transactions and e get more dan 377 million subscribers for 2024, according to dia most recent Companies House filing.
About 4.6 million creators bin post on dat site dat year, e tok.
Di company don face question on top how dem take dey police dia content and users for dia site, wey in theory gatz be 18 or ova.
For 2024, British regulators bin launch investigation into weda children dey access porn, one issue wey di company at di time bin blame on technical issue. Ofcom ultimately fine di firm about £1m.
Di company don also dey involved in legal fights wit users, including some wey feel say dem dey scammed afta dem understand say di chats dem tink say dem dey get wit OnlyFans creators na low-paid, third parties dey actually handle am.
Dem neva succeed for di cases to date.
Radvinsky bin graduate wit economics degree from Northwestern University and most recently e live for Florida, according to im website.
Apart from im OnlyFans, e invest for tech companies through one Florida-based venture capital firm, Leo.com.
Im philanthropy include donations to di Memorial Sloan Kettering Cancer Center, according to im website.










