P olice arrest Lagos autodealer 'IVD' over wife death - wetin we sabi

Wia dis foto come from, Bimbo
P olice for Lagos state, southwest Nigeria on Monday night reveal say dem don arrest one man over di death of im wife.
T oktok pesin for di Lagos state police command Benjamin Hundeyin say dem arrest di 37 year-old popular celebrity auto dealer, Ikechukwu Ogbonna aka IVD.
E say IVD currently dey for custody of di State Criminal Investigation Department (SCID) for Panti, Yaba.
D is dey come days after news of im wife death Abimbola Martins bin dey trend for di internet.
N a her sister first confam di news of her death ontop Instagram wis she also accuse say na husband IVD kill am.
H undeyin say IVD na suspsect for di death of im wife na why dem arrest am so dem go fit investigate.
E add say di purpose of di investigate wey dem dey do na to establish wether im wife death na homicide.
O n if and wen dem go charge am to court, di police toktok pesin say na dia investigate go determine.
End of Di one wey oda users dey read well well
' 'If e get to dat point, at di conclusion of investigate''. E tell BBC Pidgin.

Wia dis foto come from, Screenshot
W etin really happun?
Bimbo reportedly die from fire injuries wey she sustain allegdly after one fight with her husband for dia house for Megamound Estate, Lekki area of di state.
Di mother of five last Wednesday evening allegedly set herself ablaze after her husband allegedly beat her.
IVD imsef reportedly no dey injure too much but Bimbo sustain severe wound.
Few days later o n Saturday, her older sister enta Instagram crying say Bimbo don die.
F or di post, she accuse say na her husband of 16 years dey behind her death.
F ew hours after di news of im wife death, IVD enta Instagram and post some videos wey show how e dey get hot gbasgbos wit im mother-in-law. E also post videos of some destruction to dia house and one car. E allege say na di handwork of im late wife.
T ori be say di couple wey get five pikin together no dey new to fight-fight.
P lenti times, di husband and wife don enta social media to tok about di issues for dia marraige.
F or 2019, Bimbo regain consciousness from coma after her husband allegedly beat her - she bin dey pregnant at di time.
F or 2020, IVD wey be di husband also enta social media to share video of dia reconcilliation after Bimbo bin narrate her sufferings.
B imbo family later release one post ontop Instagram wia dem tok say IVD don dey on di run since di mata happun but di police say dis one no be true as e dey dia custody.

Wia dis foto come from, Screenshot
W ho be IVD
I VD real name na Ikechukwu Ogbonna. E dey 37 years old.
E be popular bussiness man wey dey sell moto for Lagos state southwest Nigeria.
P lenti pipo dey call am celebrity car dealer as e dey always roll wit di 'big boys' and 'big girls' otherwise known as celebrity.
E don dey married to im late wife for 16 years according to di post wey im wife family make after her death.
D i couple get five pikin together.
W ho be Bimbo
B imbola Martins na her name and she bin dey married to IVD wey be popular car dealer for Lagos.
R eport say she sabi her husband for more dan two decades.
S he na pesin wey also dey popular ontop social media.
S he die on 15 October, 2022 from injury wey she sustain from fire inicident wey happun for her matrimonial home inside Lagos.
C ases of domestic violence dey common for Nigeria
One of di cases of domestic violence wey rock Nigeria na dat of di ogbonge gospel singer Osinachi Nwachukwu wey allegedly die due to domestic violence.
H er hubsand, Peter Nwachukwu dey currently stand trial for her death.
Nigerians bin go on social media to express dia anger afta news of di gospel singer death come out.
Di goment charge Nwachukwu say e allegedly commit culpable homicide under sections 104 and 379 of di Administration of Criminal Justice Act, 2015,Di offence dey contrary to section 221 of the Penal Code and punishable wit death.
FG allege say di defendant deprive Osinachi her personal liberty as e restrain her movement and lock her up for house.
Goment accuse di defendant say e subject di late Osinachi to emotional, verbal and psychological abuse, contrary to section 14(1) of the VAP Act, 2015.
Many pipo advise married women wey dey experience abuse from dia husband to waka komot from di marriage sake of say marriage dey designed to enjoy and not endure.














