Minister of power say make Nigerians no vex but wetin make light no dey?

Bayo Adelabu wearing lemon jacket while transformer dey im back

Wia dis foto come from, Getty Images/X/Bayo Adelabu

Read am in 6 mins

To get constant electricity supply for Nigeria currently na by chance as plenti Nigerians dey experience darkness, heat and failing business.

Pipo wey dey band A, B, or C, no get constant electricity supply for Nigeria not to tok of pipo wey dey band D or E.

Several businesses dey fall, food dey rotten and price of fuel no dey smile sake of how e don increase.

Businesses like frozen-food vendors dey lose millions of naira, heat dey bite plenti pipo but still, no way out.

Poor power supply for Nigeria don dey become part of evriday dealings for Nigeria, pipo dey endure am, national grid dey fall and rise, still govment no dey provide clear reason why di kontri pipo dey sleep for darkness.

From di North to di South, West, East and evri geopolitical zones for Nigeria dey face dis painful experience.

For 2026 alone, di national grid don collapse plenti times and e no be like say any solution dey for dat one for now.

Sake of dis dark experience, Nigeria Minister of Power, Adebayo Adelabu, don dey under serious pressure as why im ministry no get any lasting solution to di epileptic power supply for di kontri.

For different places wey di Minister of Power don appear to speak on dis issue of electricity failure, e dey ask Nigerians to dey patient say constant power supply go soon show.

But for how long? Dis na kwesion wey Nigerians dey ask including wetin dey cause di poor power supply despite say electricity bill no dey stop.

Nigeria Minister of Power tender apology

Nigeria Minister of Power, Adebayo Adelabu, don apologise to Nigerians for di unstable power supply wey dem dey experience in recent times.

Adelabu tender di apology for one press conference for Lagos on Tuesday for Abuja, wia e admit say di situation don increase di hardship across homes, businesses, schools and industries.

Di hot weather plus light wey no too dey stay dey vex kontri pipo and di Minister promise say tins go improve in di next few weeks.

"No be our wish to find oursefs for dis situation, but na some factors wey actually dey beyond our control. But we no dey relent, we dey work on am 24/7 to make sure say we go back to di trend, to di trajectory of 2025 whereby you bin praise us, whereby you bin commend us for a good job well done," e tok.

E promise say power generation, transmission and distribution go improve and say "dat 6,000 megawatts go dey achieved bifor di end of dis year and Nigeria go dey beta for am".

Upon all di tok tok, di Minister of Power no tok about wetin dey really cause dis power outage.

Even Aso Rock, wey be di seat of power dey fully disconnect from di national electricity grid by 2026 sake of say dem dey complete dia solar power project, according to wetin local media report.

Report say di federal govment bin budget N10billion for di "Solarisation of di Villa wit Solar Mini Grid" project for 2025.

February 2024, Abuja Electricity Distribution Company (AEDC) bin list di Presidential Villa among di top govment debtors wey get outstanding bill of N923.87m.

Now wey di Aso Rock wan transition go solar, di State House electricity debts don near N1billion.

Dis decision by Aso Rock to comot for electricity grid don raise kwesion of wetin go come happun to ordinary Nigerians.

Di Director-General of di Energy Commission of Nigeria, Mustapha Abdullahi, say e go dey impossible for di Villa to kontinue to dey pay almost N47billion annual electricity bill.

If di seat of power dey move go solar, wetin go happun to Nigerians and who go speak up for dem?

Wetin be di reason for power wahala for Nigeria?

Nigeria electricity supply dey face serious wahala becos of di contract issues between Generation Companies (GenCos) and gas producers wey dey affect fuel delivery to power plants, dis don worsen di grid situation as blackout continue across di kontri.

Di main issue wey dey dis nationwide blackouts na plenty debts, foreign exchange challenges, and weak infrastructure, all dis continue to weaken di ability of gas power plants wey dey produce most of Nigeria electricity.

Sabi pipo say di crisis show serious mata dey wrong wit Nigeria electricity market, especially as e concern payment security and cost recovery.

Dem warn say light wahala no go end until govment address certain issues.

Di experts add say old equipment, small capacity, and poor maintenance dey affect di power network, make light dey lose for transmission.

Gas supply issues dey cause immediate problem for national grid, e dey start plenty instability and dey reduce electricity output.

Wen supply drop, power plants go dey forced to reduce work or even close down completely.

BBC News follow some pipo tok on wetin fit dey cause dis power wahala for Nigeria.

Heather Onoah, wey dey for GENCOs Board of Trustees explain say lack of transmission facilities na one of di main problems wey dey cause grid collapse.

"We no get enof transmission facilities, or network wey go carry dis power go wia dem go use am," she tok.

"So, sometimes power go even dey flow back into di system, make everytin scatter."

To end power wahala for Nigeria, experts tok say Nigeria need to upgrade and repair some parts of di power system and begin use modern methods, especially like solar energy and other alternative dat fit be sources to supply power.

One sabi pesin, John Adebayo, electrical engineer, tok say e dey important to explore different ways wey fit help improve light for Nigeria.

"Di lasting solution for Nigeria na sustainable, fit even expand reach oda countries."

E add say, "Power solution dey simple, make we use hybrid style, repair all di bad equipment on di path wey carry light reach consumers, and make hybrid dey."

Anoda expert wey chook mouth for di mata, Victoria Ibrahim, wey sabi renewable energy, tell BBC say if Nigeria use solar or hydro power wia e fit work, e go change di electricity wahala for di country.

"If we try tins like decentralization, use renewable energy from waste, small hydro or solar wia e fit work," she tok.

She add say, "Na some of dis methods fit bring us di reliable and steady power we need for Nigeria."

Wetin govment don do?

Di federal govment don dey take steps to address di liquidity crisis and make di power sector better through financial intervention and policy measures.

Dis efforts dey aimed to clear debts and restore trust in di electricity value chain again.

For December 2025, di federal govment approve to pay 185 billion naira ($134,286 ) as settlement for di money wey dem owe natural gas producers.

For June 2025, dem conclude di plan for four trillion naira ($2,903,495) bond to settle money wey dem dey owe GenCos and gas suppliers.

Stakeholders dey push for cost-reflective tariffs and improved forex access for power sector.

Despite all dis intervention, experts dey warn say if dem no do proper reforms wey go fit address pricing, liquidity, and infrastructure security, di crisis fit kontinu.

Nigeria gas supply challenges show say di finance, policy, and infrastructure dey seriously linked for energy sector.

As di kontri dey try boost industrial growth and attract investment, na to resolve dis systemic issues wey dey very important to make sure say we get stable and reliable electricity supply.