'Iran go 'avenge' citizens wey kpai for war' - Supreme leader tok and oda tins wey don happun

Wia dis foto come from, Iran President Press Office / Handout /Anadolu via Getty Images
Di new Iran supreme leader, Majtaba Khamenei don make im first message as di leader of Iran today for Iranian television.
For di message wey na di television presenter bring come outside, im emphasize say dem go still close di Strait of Hormuz and e go "avenge di blood of di killed children including di children from Minab schools".
Dis message dey come afta rumour about im health and physical condition dey go round.
The Guardian bin quote di Iran ambassador to Cyprus say e tok say, "I hear say im legs, arms and hands dey injured... I no tink say e dey comfortable to give speech".
Di IRGC public relations don announce say dem don attack wave of targets for Israel.
According to di IRGC, dis go be di 41st wave of attacks and dem say e bin dey carried out for "Tel Aviv and occupied Jerusalem".
Dem say dem run am wit "10 heavy and formidable Khorramshahr missiles wit multiple warheads, Qadr wit multiple warhead, Khybershakan wit a single-ton warhead, and hypersonic Fatah wit single-ton warhead, and destructive drones."
Dis na as di Israeli army don announce say dem don attack one "nuclear weapons development complex" for Tehran in "recent days".
Pipo for Tehran bin report say dem hear explosions for di Parchin nuclear facility.
Meanwhile, for di second time since US-Israeli war wit Iran start, di price of barrel of crude for di global market don pass $100 per barrel.
Dis dey happun as 32 kontris mostly from di West wey be members of di International Energy Agency don announce say dem go release dia emergency reserves of up to 400 million barrels of emergency reserves to dey available to di market. 172 million barrels go come from di United States.
Di closing of di Strait of Hormuz and di continued attacks on ships and oil facilities for di Persian Gulf region na di main factors wey dey drive up prices. Analysts say Russia don gain major windfall for di meantime.
Iran don announce give di pipo of Qasr Naba for di Baalbek region of Lebanon say make dem comot say dem go attack "military infrastructure wey be for Hezbollah terrorist group in di near future".
Dis one dey come afta di plenti attacks wey Israel bin sama Beirut overnight wey tori be say touch 10 Hezbollah buildings for central Beirut.
BBC Wyre Davies wey dey for Beirut bin don report say eight pipo die for attack for one of di beaches wey dey di area.
As at now, di Israeli military announce say dem don launch "massive wave" of attacks for Iran.
Di army bin write for post for di Telegram social network say di attacks go "target Iran regime infrastructure all ova di kontri".
But dis no be di end of all di tins wey dey happun for Hormuz.
Iran attacks for di Strait of Hormuz
Iran go continue to block di Strait of Hormuz, according to wetin di new supreme leader tok for statement wey dem read for state media.
Dis na as at least three more cargo ships don collect attacks for di Gulf apparently from Iran hand. But di Iran state media say Iranian forces get hand for at least one of di attacks.
Meanwhile di UK Defence Secretary, Jon Healey say e dey follow military planners and allies tok about di mata for di Strait of Hormuz.
E say reports don dey clearer say Iran "fit just dey mine" di Strait.
One pesin bin die for US-owned tanker off di coast of Iraq. Dis vessel, tori be say one unmanned speed boat wey carry explosives bin hit am..
Di oda two na one vessel wey bin dey go Iraqi port and di Chinese vessel dem hit near di Strait of Hormuz.
Wetin Mojtaba Khamenei tok as first message as new leader of Iran
For wetin BBC Persia help to translate, Khamenei tok say, di "lever of blocking di Strait of Hormuz" suppose still dey used by Iran.
E add say Iran get policy of "friendship" wit dia neighbour kontris but e advise dem say make dem close American bases wey im tok say Iran go continue to dey target.
Oga Khamenei also tok say Iran no go hesitate to "avenge di blood of Iranians" wey don dey killed.
E say e even dey more true for Minab wia US strike attack one school kill 168 pipo, around 110 of who be children. Iran say na US missile hit di school but US Defence Secretary Pete Hegseth tok say dem dey investigate am.
But even wit di statement nobodi don see di new supreme leader for state media and dis one don start tok-tok online as to weda di new leader don injure or even if e still dey alive.
Di informate wey don comot dey small.
Iran state TV tok about am say e be "veteran of di Ramadan war" and dem no tok weda im injure. But Reuters report bin quote one unnamed Iran officer wey say e dey, "lightly injured".










