Brazil maintain dominance over Nigeria wit victory for opening group game at 2024 Olympics

Wia dis foto come from, Getty Images
Brazil win dia first match for di Womenβs football event of di 2024 Paris Olympics.
Di two-time silver medallists beat Nigeria 0-1 afta Gabi Nunes score from Martha assist.
Martha bin score few minutes later but di goal no stand.
Brazil dominate Nigeria for ball possession but Nigeria hold dem for work.
Di Super Falcons bin get beta chances wey Captain Rasheedat Ajibade create but she no get di needed support upfront.
Dis na di second time wey Brazil women go defeat di Super Falcons for Olympic Games. For 2008, dem also beat Nigeria 3-1.
Nigeria go need pick demsef up and go again on Sunday wen dem go face off against current Women World Cup holders, Spain.
Brazil on di oda hand go try to qualify for di next round as dem go play Japan for dia second group game on di same day.
Match Highlights
Second Half
Full time Nigeria 0-1 Brazil
90+8 Referee blow whistle, match don end.
90+7 Last chance for Nigeria to get something out of dis match, Ajibade make goal bound move but dem bring her down.
90+7 Nigeria hold ball for di remaining few seconds. Dem still dey find goal.
90+5 Rasheedat Ajibade play di corner but Brazil defence clear di ball.
90+3 Injury for Brazil player wey take treatment for pitch, dem don finally remove Portilho from field.
90+ 2 Nigeria hold possession of di ball dey try break into di Brazil Defence, corner kick for Nigeria.
90β Referee add 6 minutes.
88β Corner kick for Nigeria, Rasheedat Ajibade play am well but Brazil goalkeeper Lorena catch di ball.
86β Beta free kick wey Nigeria play land for Brazil goalkeeper Lorena hand as she dive punch di ball.
85β Freekick for Nigeria afta Gani Portilho bring down Nigeria player.
84β Nigeria no gree give up o, dem still dey attack Brazil.
80β Deborah Abiodun of Nigeria get chance but she rush play so ball above di goal post.
80β Game don kontinu, Nigeria don begin attack Brazil, throw-in for Nigeria.
79β Referee stop match sake or injury wey Brazil player get.
75β Substitution for Nigeria Nicola Payne don enta for Okeke.
73β Freekick for Brazil But not in come out.
72β Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie save goal attempt from Brazil.
70β SAVE! Rasheedat Ajibade make beta goal attempt she fire shot wey land for Brazil goalkeeper Lorena hand bounce back, but di rebound go wide.
69β Brazil dey use Nigeria shine for ball possession but di Super Falcons still dey hustle to get possession.
67β Double substitution for Nigeria, Echegini don comot and Onumonu replace her, Toni Payne also comot for Uchenna Kanu to enta.
66β Yaya wey get yellow card don comot for Ana Vitoria.
65β Substitution for Brazil, Jheniffer done enta for Ludmila.
64β Side netting! for Brazil
62β Ludmila of Brazil make goal attempt but Nigeria defender Demehin clear di ball, corner kick for Brazil
60β Close! Martha of Brazil fire shot from di corner flank but e hit di post.
59β Brazil still dey dominate possession.
57β Nigeria get throw-in but e land for Brazil player leg, Brazil still hold di ball.
54β Nigeria defender Okeke clear di ball from Brazil player wey dey run go Nigeria goal area.
52β Agabi Nunes of Brazilian bin wan score from a goal mouth scramble but Chiamaka catch di ball early.
51β Long pass from Ludmila of Brazil buy Nigeria goalkeeper Chiamaka catch di ball without stress.
49β Christy Ucheibe of Nigeria clear one goal threat from Brazil.
47β Brazil don begin attack Nigeria now now but Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie come out quick to catch di ball.
46β Substitution for Nigeria, Esther Okoronkwo don enta For Chinwendu Ihezuo.
46β Referee don blow whistle to indicate di beginning of second half
First Half

Wia dis foto come from, Getty Images
45+9 First half don end.
45+9 Toni Payne of Nigeria make beta run fire shot from outside di box but e go over di post.
45+8 Martha of Brazil bin get chance but she fire di ball wide off di post.
45+ 45+4 Yasmin of Brazil play so corner kick but notin come out.
45+3 Corner kick for Brazil na Yasmin go play am.
45+2 Brazilian player complain to referee for posible penalty sake of hand ball but referee say no be handball.
45β Referee add 7 minutes sake of di plenti injuries wey happening di match.
43β Rasheedat Ajibade try to drive thru di middle towards di Brazilian goal area but dem no give her chance.
41β Corner kick for Nigeria, Toni Payne play am but notin come out.
40β Brazilian dey attack Nigeria defence but di defenders no dey give dem chance again.
36β Substitution for Brazil, Tamires don comot sake of injury, Yasmin replace her.
Nigeria 0-1 Brazil
37β GOAL for Brazil, Gabi Nunes fire shot wey beat Nigeria defender Chiamaka Nnadozie afta Martha pass ball give her.
33β Ajibade of Nigeria carry di ball to di BrazilIan goal area but oda teammates no dey to give her support until dem bring her down. Cornet kick for Nigeria.
29β Nigeria midfielder Christy Ucheibe foul Tamires of Brazil, referee blow foul, Tamires don dey okay now and match don kontinu.
27β Yellow card for Brazilian player Yaya.
27β Brazilian player Yaha make solo run to Nigeria goal area but Toni Payne clear di ball from her leg.
23β Brazilian player Portilho dey down dey receiv treatment afta Nigeria player hit her by mistake. She done enta pitch back.
22β Portilho of Brazi strike from di left post but e no enta net. Goal kick for Nigeria.
20β Martha of Brazil fire shot as she make goal attempt but Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie catch di ball without stress.
20β Na battle of midfield now as Nigeria and Brazil dey drag ball for di middle.
17β Be like say Brazilian goalkeeper Lorena get injury from di stretch wey she do to save dis strikes but she dey fine now, game don kontinu.
15β SAVE! Brazilian goalkeeper Lorena save two goal attempts from Nigeria. Rasheedat Ajibade strike and Christy Ucheibe strike.
13β Rasheedat Ajibade of Nigeria beat two Brazilian defenders as she dey approach di goal area but dem bring her down.
12β Alozie don stand up and game done kontinu.
10β Nigeria Defebeer Michelle Alozie dey ground afta she intercept one ball from one Brazilian player.
9β Throw-in for Nigeria but e land for Brazil player leg, Rasheedat intercept di ball.
7β Nigeria captain Rasheedat Ajibade make one beta run for di flanks as she dey drive into di Brazilian defence but dem collect ball from her leg.
4β Freekick to Brazil, dem play am but Nigeria defenders no let di ball disturb dem.
3β Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie clear one ball.
1β Referee Yu- Jeong from Korea don blow whistle and match don start.
Line ups
Nigeria starting 11: Nnadozie, Okeke, Ohale, Demehin, Alozie, Ucheibe, Abiodun, Ajibade, Echegini, Payne, Ihezuo
Brazil starting 11: Lorena, Tamires, Tarciane, Rafaelle Souza, AntΓ΄nia, Marta, Duda Sampaio, YayΓ‘, Ludmila, Gabi Portilho, Gabi Nunes










