Senegal reject decision, to go court as CAF comot 2025 Afcon title from dem give Morocco

Wia dis foto come from, SEBASTIEN BOZON / AFP via Getty Images
Senegal say dem no go gree for for Caf afta di Africa Football governing body remove di 2025 Afcon title from di West African kontri.
Na on Tuesday Caf declare Morocco as di winner of di 2025 Africa Cup of Nations afta dem cancel di result of dia final defeat to Senegal sake of say dem waka comot from di football field.
Caf tok say na sake of a delay of around 17 minutes, bifor di players eventually return and save Brahim Diaz penalty before Senegal Pape Gueye score extra-time winner dem dey cancel di original match result.
Statement from Caf say Senegal dey "declared to don surrender di final match" wit di "result of di match – and record 3-0 in favour" of Morocco.
Di decision follow appeal by Moroccan FA (FRMF) wey Caf say dey "declared acceptable in form" and dem uphold am.
Caf add say "through di conduct of dia team" Senegal violate Article 82 of regulations of di Africa Cup of Nations and sake of dat, dem apply Article 84.
Article 82 say if team no gree play or leave di field before di end of regulation time without di referee authorisation, dem go consider dem as loser and knack dem comot from di competition.
Article 84 complement di provision, say any team wey violate Articles 82 go dey permanently eliminated and go lose di match 3-0.
Caf also take oda disciplinary decisions against some players and di federation. some of dem na:
- Caf reduce di match ban of Saibari from three to two sake of say e tamper wit di Senegal goalkeeper towel. Dem also cancel di $100,000 fine set wey dem bin sama Saibari.
- Caf reduce di $200,000 fine wey dem sama Morocco for di conduct of di ball boys. Dem reduce am to $50,000.
- Di $15,000 fine wey Caf also sama Morocco sake of say dia fans use lasers during di final, Caf also reduce am to $10,000.
Senegal reject decision, drag Caf go court
Senegal don tok say dem no go agree wit di disciplinary decision wey Caf take and dem go follow di mata to di end.
For statement wey di Senegalese Football Federation (FSF) release, on 17 March, 2026, dem tok say dem don "take note of di notification of di notification of di decision by di Appeals Board of Caf for case DC23316.
Senegal say dem no agree wit di decision at all and dem go drag di mata to any football level wia dem go get justice.
"Di Senegalese Federation reject di unfair, unprecedented, and unacceptable decision wey discredit African football."
Di football federation say dem go defend dia rights to any level.
"Di federation go initiate an appeal as soon as possible bifor di Court of Arbitration for Sport (CAS) for Lausanne.
"Di FSF reaffirm our unwavering commitment to di values of integrity and sporting justice."
'We no intend to challenge sporting performance' - Morocco
Di Royal Morocco Football Federation also react afta dem confam say dem don receive di notification from Caf on di deceision wey di disciplinary board make.
Morocco say dem too don take note of di Caf decision to award dem di Afcon 2025 title.
Dem add say "di approach no dey intended to challenge di sporting performance of di teams wey participate for dis competition but na only to request make dem apply regulations for di comp[etition".
For statement, dem tok say dem dey committed to respect di rules and ensure clarity for di competitive framework and maintain stability within Africa.
Wetin happun for Morocco vs Senegal Afcon final

Wia dis foto come from, ABDEL MAJID BZIOUAT/AFP VIA GETTY IMAGES
Chaos breakout for di last minutes for dat game afta referee and VAR give penalty to Morocco for foul on Brahim Diaz.
Di game scata for 17 minutes as Senegal players boycott di game wey dem waka comot di park.
Senegal players vex sake of di centre referee blow whistle for foul inside di Morocco box bifor Senegal score dia goal.
Sake of di ref already bin blow di whistle, di VAR no fit check di incident – but Senegal players and coaches no gree.
Al Nassr forward and former Liverpool player Sadio Mane call out his teammates to return to di park and continue di game.
Youssef En-Nesyri wey be di penalty taker carry di ball give Brahim Diaz wey bin get five goals for di tournament.
But wit di chance to win dia next Afcon title in 50 years, Brahim Diaz try di Panenka penalty wey Edouard Mendy save di ball.
Senegal bin go ahead to score di winning goal for extra time thru Pape Gueye to break di hearts of Morocco players and fans.
Di incident make Caf announce say dem go chook eye for di videos from di game to act against players and officials wey scata di game for di last minute.
"We condemn di unacceptable behaviour of some players and officials during di final – Caf no dey support behaviour like dat especially those wey dey target di refereeing team or match organizers."
"Caf dey review all di footage wey we go refer di mata to sabi pipo for act against di pipo wey go dey guilty," di footbal body tok for statement di time di incident happun.
Also, Fifa president Gianni Infantino wey watch di game for di stadium also "condemn some Senegal players for di unacceptable scenes" wey overshadow di final.
Infantino tok inside one statement to AFP say "we strongly condemn dis behaviour of some Senegal players and technical staff members."
"Na unacceptable to comot di park like dat wey equally violence no dey tolerated for our sport; e just no be right."










