Buffy the Vampire Slayer actor Nicholas Brendon die at di age of 54

Headshot of Nicholas Brendon, Buffy actor

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Harry Sekulich
  • Read am in 2 mins

US actor Nicholas Brendon, wey dey known for im role for di cult TV series Buffy the Vampire Slayer, don die at di age of 54.

Brendon family confam am for statement on social media "e die for im sleep of natural causes".

Im family add say: "E bin dey passionate, sensitive, and love to create endlessly. Those wey truly know am understand say im art na one of di purest reflections of who e be.

"Most pipo know Nicky for im work as actor and for di character e bin bring to life over di years. In recent years Nicky bin find im passion in painting and art."

Brendon play Xander Harris inside Buffy the Vampire Slayer over seven seasons between 1997 and 2003 - e be best friend of di titular character wey Sarah Michelle Gellar act. Dem bin cancel one planned reboot of Buffy, Gellar announce to fans on Instagram earlier dis month.

Di Los Angeles-born actor receive three Emmy nominations for im role inside Buffy, two for best TV actor and one for best TV supporting actor.

Brendon twin brother Kelly Donovan Schultz also stand in as im brother body double inside two episodes of Buffy.

E also act alongside Alyson Hannigan, wey post tribute inside post on Instagram. She write: "My Sweet Nicky, thank you for years of laughter, love and Dodgers. I go tink of you every time I see rocking chair. I love you. RIP."

After Buffy, Brendon act for various shows including Criminal Minds, Private Practice and Kitchen Confidential.

Im film credit also include Psycho Beach Party, Big Gay Love, and Redwood.

Brendon bin dey open about im health struggles, including one heart attack, and e bin do two spinal surgeries for cauda equina syndrome, one rare condition wey fit affect movement as well as bladder and bowel function.

Di actor bin also be stammerer, e later dey advocate for am as a spokesperson for di Stuttering Foundation of America.

Di late actor bin also open up about im struggles with substance addiction, alcoholism and mental health issues.

Im family tell di Hollywood Reporter say: "While no be secret say Nicholas bin get struggles in di past, e bin dey on medications and treatment to manage im diagnosis and e bin get hope about di future at di time wey e die."