Trump don pause im plan to strike Iran energy plants by 10 days

President Donald Trump during di Cabinet meeting wey hold for White House Cabinet Room on March 26, 2026 for Washington, DC. Dis na Trump second Cabinet meeting for 2026 and di first one since United States and Israel don start to attack Iran on February 28.

Wia dis foto come from, Chip Somodevilla/Getty Images

Read am in 4 mins

Trump don extend pause on striking Iranian energy plants by 10 days.

President Trump post dis for Truth Social, as e announce di extension of di pause on striking Iranian energy plants on Monday.

Trump claim say tok still dey go on between Washington and Tehran.

Donald Trump don extend di pause on striking Iranian energy plants from five days to two weeks.

Dis one suppose expire by di end of dis week but di extension wey Trump annouce mean say di pause go dey in effect uill 6 April.

We neva hear Iran response, but inside di post Trump tok say di announcement dey come afta di request from di Iranian government.

"As Iranian Government request, make dis statement represent say I go pause di Energy Plant destruction for 10 days to Monday, April 6, 2026, at 8 P.M. Eastern Time. Tok-tok dey ongoing and depsite some statements to di contrary by di Fake News Media and odas, edey go well. Thank you for your attention to dis matta! President DONALD J. TRUMP," Trump tok on im social post on Monday.

Oil price drop afta wetin Trump latest comments

Stocks for US don fall again on Thursday, as dem sell-off key tech companies wey make investors begin worry about di war.

Di Nasdaq index wia many tech firms dey listed, drop nearly 2.4%, as Meta shares drop sharply afta di back-to-back juries don find against di company for one court case in US.

Di drop push di index down 11% from di most recent high for October, and e don put am for correction territory.

Di S&P 500 drop 1.7%, while Dow fall 1%.

Shortly afta market don close for US, Trump tok say e go hold on strikes against Iran energy sites till 6 April.

Oil prices, wey don rise on Thursday becos of concern say supply go dey tight due to di war, drop back afta Trump post for social media.

Brent crude futures don settle around $108 per barrel but na about one dollar lower afta Trump announce am.

Israeli strikes don continue for Lebanon and Iran

Israeli strikes continue for Lebanon and Iran as US President Donald Trump claim say Iran dey beg to make deal. Hia na wetin una suppose sabi:

Iran: Israel tok say dia air force don carry out about 20 strikes on "launch sites" for western Iran so far today. Dis dey come afta Israel announce early dis morning say dem don launch "wide-scale" wave of strikes against Isfahan city and several oda areas.

Lebanon: Di state-run National News Agency report say di death toll since di conflict don start, wen US and Israel attack Iran, don rise to ova 1,100 as IDF continue to attack southern Lebanon, wit both strikes and military force on di ground.

Israel: Di IDF don annouce say dem detect missiles wey dey come from Iran. One pesin die afta missile attack for northern Israel, according to emergency service Magen David Adom.

Energy prices: All over di world, kontris dey announce measures to handle energy prices wey dey rise sharply. Poland dey plan to reduce VAT for fuel, German lawmakers approve measures to limit price increase for petrol stations and South Korea don announce say dem go ease limits on coal-fired energy production and boost nuclear power plant use.

Trump first cabinet meeting since war don start: Earlier, Trump tok say Iran dey beg to make deal and warn Tehran to carry peace plan follow through. Iran don dey deny say dem dey tok to end war.

Trump claim say Iran don send am "present" of 10 oil tankers wey dem allow to sail through di Strait of Hormuz.

Missile and drone attacks dey happun for Middle East

Saudi Arabia don catch and destroy four extra drones for dia east region, di ministry of defence tok am for X, and plenty oda interceptions dem don announce in di past 24 hours.

Kuwait dey face missile and drone attacks, di army don post for X. Dem warn pipo say dem fit hear bomb blast from di interception, make dem follow safety guidelines wey di government don issue.