Iran threaten to revenge against Gulf energy and water if Trump attack dia power plants

Three men dey work on oil plant for middle east

Wia dis foto come from, SEDAT SUNA / GETT IMAGES

Read am in 3 mins

Iran say dem go attack Israel power plant if President Donald Trump carry out him threat to scatter Iran power network, Reuters report.

For statement on Monday, Iran Revolutionary Guards say dem dey ready to respond to any threat as e dey come, dey go dey do back.

"If you hit our electricity, we go hit una electricity".

On Saturday Trump bin warn say if Tehran no fully reopen di Strait of Hormuz for shipping within 48 hours, dem go destroy Iran power plants. E say di deadline na Monday 7:45pm (2345 GMT).

Sake of di attacks for Iran, dem close di Strait of Hormuz wey dey hold a fifth of global oil and liquidified natural gas wey cause di worst oil crisis for di world since 1970s.

Dem don kill more dan 2000 pipo since US and Israel start di war for February. Di war don cause high cost of tins, increase cost of fuel and cause major inflation fears globally.

After more dan three weeks of heavy US and Israel bombardment on Iran, officials say dem don reduce Iran missile capabilities but Tehran still dey show say dem able to strike back.

For Sunday night dem blow air raid sirens across parts of northern and central Israel including Tel Aviv and West Bank say missiles dey come from Iran.

Israel military on Monday say dem don begin wide scale wave of strikes wey dey target Iran infrastructure for Tehran.

Washington Post on Monday report on social media say Iran Supreme Leader Mojtaba Khamenei dey injured, isolated and no dey respond to messages.

Khameni bin succeed im papa Ayatollah Ali Khamenei wey dem bin kill during di first wave of di war on February 28. Dem neva see am for public since dem elevate am.

For Saudi Arabia, di defence ministry on Monday say two missiles enter di kontri, dem intercept one, while di other one fall for uninhabited area.

Trump warning to strike Iran power plants dey come less dan day afta im bin tok say US fit consider to wind down di conflict, even though US Marines and heavy landing crafts bin dey head to di region.

If dem attack Iran electricity, e fit hurt Iran, but e fit set catastrophic for dia Gulf neighbors wey dey consume around five times more power.

Na electricity dem dey use make di deserts habitable. Dem dey power di desalination plants to produce 100 percent of water dem dey consume for Bahrain and Qatar.

Di plants dey use seawater to meet more dan 80 percent of drinking water for United Arab Emirates and 50 percent of water supply to Saudi Arabia.