Court sama former Accountant-General 72 years imprisonment sake of fraud

Wia dis foto come from, EFCC
One former acting Accountant-General of Nigeria don land for prison afta court sama am wit 72 years jail sentence.
E dey face nine count amended charges of money laundering to di tune of 868,465,000 naira (Eight Hundred and Sixty-eight Million, Four Hundred and Sixty-five Thousand Naira).
Justice James Omotosho of di Federal High Court for Abuja convict and sentence di former acting Accountant-General of di Federation, Chukwunyere Nwabuoku, to 72-year for prison witout any option of fine.
For di judgment wey Justice Omotosho give, im tok say di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don prove di nine-count of money laundering charge wey dem sama am beyond reasonable doubt.
Di judge say Mr Nwabuoku dey guilty as charged and court don convict am accordingly.
Court sama am eight years imprisonment for each of di counts wey be 72 years in total but all di jail term for all di counts go run di same time.
Justice Omotosho, describe wetin Nwabuoku do, as im divert money wey dem suppose use for security and defence wen im bin serve as Director of Finance and Accounts for di Ministry of Defence as "appalling," as e clap hand for EFCC say dem do beta work.
Di judge observe say di evidence of di 9th prosecution witness wey show say Nwabuoku bin voluntarily refund part of di money wey im divert wey be ova ₦200 million during di investigation, di defence no argue am at all.
Dem bin arraign am on 15 January, 2025 sake of nine-count charge wey dem bin amend and dem bin grant am bail of ₦500 million wit two sureties.
Dem bin allege say na between 2019 and 2021 wey Nwabuoku divert di money wen im bin dey serve as di Director of Finance and Accounts for di Ministry of Defence
Who be Chukwunyere Nwabuoku?
Chukwunyere Nwabuoku start im civil service career for di Centre for Democratic Studies (CDS).
From dia, im rise to di position of Principal Accountant between 1992 and 1995.
Dem kon transfer am go di Office of di Accountant General of di Federation, Abuja from 1996 to 2001 as Assistant Chief Accountant.
Im bin work for di National Assembly, Office of di Senate President from 2001 to 2003 as Special Assistant to di Senate President on Public Affairs.
Former President Muhammadu Buhari bin appoint am to di Office of di Accountant-General of di Federation for 2019.
Na wen EFCC bin dey investigate anoda former Accountant-General of di Federation for financial misappropriation na im dem appoint am to take charge.
Im be Director, Inspectorate Office of di Accountant-General of di Federation bifor Buhari appoint am.
According to local media, Mr Nwabuoku get Higher National Diploma (HND) in Accountancy from di Institute of Management and Technology (IMT) Enugu.
Im also get Master of Science (MSc) in Financial Management from Common Wealth University, Belize.










