Sultan of Sokoto declare Friday as Eid-al-Fitr

Sultan of Sokoto Muhammad Sa'ad Abubakar

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Di Sultan of Sokoto Muhammad Sa'ad Abubakar don announce Friday, 20 March 2026 as di first day of Shawwal 1447AH, afta dem no sight di crescent wey dey signal di end of Ramadan.

Di Sultan make di announcement for inside one statement wey di Chairman of di Advisory Committee on Religious Affairs, Sultanate Council, Sokoto, Sambo Wali Junaidu sign in collaboration wit di National Moon Sighting Committee for Nigeria.

According to di statement, dem no receive any credible reports from across di kontri wey confam di sighting of di Shawwal moon on Wednesday, 18 March wey mark di 29th day of Ramadan.

E say sake of dat, Thursday, 19 March 19 go be di 30th day of Ramadan 1447AH.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Muslims praying at Eid

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Sultan of Sokoto also approve di declaration of Friday as di day for Eid-el-Fitr.

E congratulate Muslims on di successful completion of Ramadan and call for sustained prayers for national unity and development.

Di Sultan announcement bin come afta Nigeria govment declare Thursday, 19 March, and Friday, 20 March as public holidays to mark di celebration of Eid-el-Fitr, wey signify di end of di holy month of Ramadan.

Di Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo make di announcement for inside statement on Tuesday.

E hail Muslim faithful on di successful completion of di holy month of Ramadan .and urge Nigerians to use di festive period to pray for di continued peace, unity, and prosperity of di nation.

Di feast of Eid-al-Fitr na wen Muslims around di world dey mark di end of di holy month of Ramadan.

Eid al-Fitr (wey also dey known as Eid ul-Fitr) mean 'festival of di breaking of di fast' and e mark di end of di period wen Muslims dey fast – during di fast, dem go refuse food and drink - between dawn and sunset.

Na di cycle of di Moon dey decide di actual date of Eid al-Fitr, wey dem dey count following di start of Ramadan.

Eid al-Fitr dey start wen new moon appear for di evening sky, dis one mean say Eid no dey always fall on di same day or date each year.

Di Sultan of Sokoto and President-General of di Nigerian Supreme Council for Islamic Affairs (NSCIA), Sa'ad Abubakar, bin direct Muslims across Nigeria to begin di search for di new Moon of Shawwal 1447 AH from Wednesday, 18 February.

For one statement wey di NSCIA release on dia official X account, e say if dem sight di moon on Wednesday, dem go inform di Sultan either directly or through di National Moon Sighting Committee (NMSC), but if dem no sight di crescent on Wednesday, di 'Id go dey observed on Friday, 20 March.

Di sighting of di Shawwal crescent na im dey signal di end of di month-long Ramadan fast and announce di celebration of Eid al-Fitr by Muslims worldwide.

Na di Sultan of Sokoto, wey also be di spiritual leader of Muslims for Nigeria dey proclaim end of di Ramadan afta verified moon sightings dey reported from across di kontri.

Na di announcement dey determine di official date for Eid al-Fitr prayers and celebrations nationwide.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Security ginger across di kontri ahead of Eid-el-fitr

Police officers stand

Wia dis foto come from, Oyo state police command/X

Meanwhile, di Nigeria Police Force and di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC) don ginger security deployments nationwide to ensure a peaceful Eid-el-Fitr celebration.

For Lagos, di Commissioner of Police Olohundare Jimoh say im don order extensive security deployment across di state to guarantee peaceful and hitch-free Eid-il-Fitr celebration, especially for Eid prayer grounds, mosques, markets, recreational centres, plus oda public places wey many pipo go dey.

Ogun State police say to ensure peaceful and secure Eid-el-Fitr celebration, dem don place high priority on di protection of worship centres, critical infrastructure, and di safety of all residents bifor, during, and afta di festive period.

Edo State police say dem don deploy 5,000 police personnel to improve police visibility, dominate public spaces and respond promptly to any emerging situation.

Di deployment cut across Eid prayer grounds, major roads, motor parks, plus oda locations wey dey expected to witness large gatherings, di police tok.

Police for Zamfara, Kaduna, Borno, and oda states across di kontri don also deploy massive security ahead of di Eid.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3