Tolulope Arotile death: Court charge suspect with culpable homicide for accident wey kill Nigerian Air force flying officer

Wia dis foto come from, Alamy
One Magistrate Court for Kaduna state don charge di first suspect Nehemiah Adejor wey drive di car wey kill Nigeria First Female Flying Officer Tolulope Arotile for culpable homicide and criminal conspiracy wey no dey punishable by death.
Di second and third suspects, Folorunsho Igbekele Faith and Gbayegun Deji wey dem charge in connection wit di death of di flying officer Tolulope Arotile don dey free.
Di Prosecution Counsel, DSP Martins D. Leo, tell di court to free di second and third suspects, as their investigation no show say dem get anything to do wit her death.

Wia dis foto come from, NAF
Di DPP for im submission tell di court say plenty sufficient evidence dey to nail di first suspect, Nehemiah Adejor for culpable homicide wey no dey punishable by death.
For im ruling, di presiding Justice Benjamin Hassan, discharge di second and third suspects base ontop di police investigation.
Di 24 year old flying officer Tolulope Arotile die on 14 July 2020. Di Nigerian Air Force wey announce am for dia twitter handle say di young flying officer die from head injury wey she get from di road accident wey happun for NAF base Kaduna.
Dia preliminary investigation reveal say, Arotile die as a result of "blunt force trauma and too much bleeding afta her secondary school mates Mr Nehemiah Adejoh, Mr Igbekele Folorunsho and Mr Festus Gbayegun, drive pass her inside dia Kia Sorento SUV, with Registration Number AZ 478 MKA jam her".
Wetin be culpable Homicide?
Court don charge di main suspect Nehemiah Adejor wit culpable homicide wey no dey punishable by death.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis one mean say di court find am responsible for di death of di flying officer but di death happun by accident and im no get di intention to kill her and because of say na mistake di court no give am death sentence.
Di punishment na to go prison for like 10 years or life imprisonment according to di ruling of di judge.











