Israel say dem kill Iran navy chief Alireza Tangsiri

Wia dis foto come from, TASNIM
Israel say dem don kill di commander of Iran Islamic Revolutionary Guards Corps (IRGC)'s Navy, Alireza Tangsiri.
Defence Minister Israel Katz say Tangsiri bin "directly dey responsible for di terrorist act of bombing and blocking di Strait of Hormuz", and dem don "blown am up".
Im add say dem kpai a number of oda "senior Navy command officials"
Iran neva comment on dis development yet.
Who be Alireza Tangsiri, di IRGC navy commander Israel say dem don kill?
Dem bin appoint Alireza Tangsiri as di commander of di Navy of di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) for 2018.
Im bin don serve as di deputy commander of di IRGC navy from 2010.
On X account wey dem tok say na im own dey active since 10 March dis year, wit Iranian outlets wey dey quote from di posts wey im bin dey make dia.
For di posts, im bin don post several times about di Strait of Hormuz. Di account bin don tok say "no vessel wey dey associated wit di aggressors against Iran get di right to pass through".
End of Di one wey oda users dey read well well
Tangsiri na commander wey sabi tok well-well, im bin don make several statements against di US and Israel bifor.
For 2019 im bin threaten to close di Strait of Hormuz if anytin disrupt Iran oil exports.
Di US Treasury bin sanction Tangsiri wit oda IRGC commanders for 2019 afta Iran shoot down one US surveillance drone near di strait.
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu describe Tangsiri as an individual wey get "a great deal of blood on for im hands" and im tok say im assassination na "yet anoda example of di co-operation between us and our friend, di United States, toward di common goal of achieving di objectives of di war".
US Central Command tok for statement say Tangsiri death "make di region safer" and say di IRGC navy "dey on an irreversible decline". E also tell serving members of di IRGC to abandon dia posts and return home "to avoid further risk of unnecessary injury or death".
Israel military tok for statement wey dem post on X say di head of di IRGC Navy intelligence directorate, Behnam Rezaei, also "kpai".
How many pipo don die for di US-Israel war wit Iran?
Even though e dey difficult to independently verify all figures, di death toll from di war for di Middle East be like say e don pass 4,500.
As at di time of filing dis report, Iran dey suffer di heaviest losses, wit US-based rights group HRANA wey estimate 3,291 deaths - including 1,455 civilians.
For Lebanon, wia Israel dey carry out strikes against Hezbollah, 1,072 pipo na im don kpai, according to di Lebanese health ministry.
According to di Iraqi authorities, at least 81 pipo don kpai for Iraq, mostly members of di Hashed al-Shaabi (Popular Mobilisation Forces, PMF), wey get links to Iran.
Israel bin don report 18 deaths, mostly from missile attacks. Di Israeli military say two sojas bin die for southern Lebanon.
Di US say dem don lose 13 service members, including six for di refuelling aircraft crash over Iraq.
One separate incident bin kill seven pipo for Qatar wen one helicopter malfunctioned during "routine duty", according to Qatar defence ministry.
Di UAE defence ministry confam nine deaths, including three armed forces members and six civilians.
Kuwait bin don report six deaths, including two interior ministry officers and two army soldiers.
Dem bin also report strikes wey bin kill four pipo for Syria, four for di West Bank, two in Bahrain, two for Oman and two for Saudi Arabia.














