Israel say Iran security chief Ali Larijani don die inside strike

Iran security chief Ali Larijani

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Israel say dem don kill Iran top security official, Ali Larijani, plus di head of di paramilitary Basij force, Gholamreza Soleimani for inside one Israeli air strikes.

"Larijani and di Basij commander dey eliminated last night and don go join Khamenei, di head of di annihilation programme, plus all di pipo dem eliminate from di Axis of Evil for di depths of hell," Defence Minister Israel Katz tok.

Iranian authorities neva confam dia deaths.

Larijani go be di most senior Iranian official to dey assassinated since di Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, die on di first day of Israeli and US strikes on 28 February.

Dem trigger war wey don spread across di Middle East, and Iran retaliate by launching missiles and drones for Israel and Arab states wey dey host US military facilities.

Di price of oil don rise, as Iranian attacks force production stoppages for Gulf states and mess up exports through di vital Strait of Hormuz waterway.

Di Israeli army post on X say "im removal don add to di dozens of senior commanders of di Iranian terrorist regime armed forces wey don die during di operation and dem don deal anoda severe blow to di regime security command and control structures."

Di last foto of Ali Larijani for public na during di Quds Day march for Tehran on 13 March, according to im X account wey appear to show am for street as e dey wave and tok to supporters.

A day earlier, e bin taunt President Trump on social media, as e post on X say "Trump say e dey look for speedy victory. While e dey easy to start war, e no dey easy to win wit few tweets."

"We no go stop until we make you dey sorry for dis grave miscalculation."

For anoda post on 10 March, Larijani tok say Iran no dey fear Trump "threats", and add say, "even dos wey big pass you no fit eliminate Iranian nation".

"Be careful, so you no go dey eliminated," e add.

Di Israel Defense Forces (IDF) announce say dia air force bin carry out "precise strike" near Tehran on Monday night wey kill Ali Larijani, wey describe am as "one of di most veteran and senior figures within di Iranian regime".

"Following di elimination of Khamenei, Larijani cement im status as di de-facto leader of di Iranian regime and e lead di combat efforts against di State of Israel and countries across di region," dem tok.

Later, Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu say: "We dey undermine dis regime in di hope say we wan give Iranian pipo opportunity to remove am."

Iranian authorities don comment on di Israeli statements, wey come afta one night of heavy bombardment for Tehran combined wit di sound of thunder.

But shortly afta Katz statement, Larijani social media accounts bin post one handwritten note wey no get date but wey di state media report say e write on Tuesday.

Di note hail di 84 "warriors" of di Iranian navy wey die for one US submarine attack on dia warship off di coast of Sri Lanka dis month. Iran dey ready to hold one ceremony to honour di sailors on Tuesday evening.

State TV read out one similar message about di sailors from di commander of di Basij Resistance Force, Gholamreza Soleimani, wey di IDF tok say dem kill for anoda overnight strike.

Di Basij na volunteer militia wey dia estimated one million members dey often call out for streets to use force to suppress dissent. E dey controlled by di powerful Islamic Revolution Guard Corps (IRGC).

"During internal protests for Iran, particularly in recent periods as demonstrations intensified, Basij forces under Soleimani's command lead di main repression operations," di IDF tok.

Larijani is believed to have overseen the unprecedented crackdown by the Basij and other security forces on the protests that swept across Iran in December and January. At least 6,508 protesters were killed and 53,000 arrested, human rights activists say.

Ali Ardeshir Larijani profile

Ali Larijani na di influential secretary of Iran Supreme National Security Council (SNSC).

President Masoud Pezeshkian appoint am forr August 2025 as secretary of di SNSC and as di representative of Iran late Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, to di council.

E dey described for Iranian outlets as adviser to di late supreme leader. E serve as speaker of Iran parliament for 12 years, from May 2008 to May 2020.

Although, e head di Principalist faction for parliament from 2008 to 2012, e dey described as a "moderate conservative" in recent years.

Bifor e bicom speaker, Larijani bin serve as Iran chief nuclear negotiator between 2005 and 2007.

Im brother, Sadegh Larijani, na anoda influential figure for di Islamic Republic. E chair di Expediency Council, one top arbitration body wey dey serve as di final arbiter between parliament and di constitutional watchdog, di Guardian Council.

Born in 1953 in Najaf

1989 to 1992: Deputy Chief of di IRGC Joint Staff

1992 to 1993: Minister of Culture and Islamic Guidance

1993 to 2004: Head of di Iranian Broadcasting Organization

2005 to 2007: Secretary of di Supreme National Security Council

2008 to 2020: Three terms as representative and speaker of di Islamic Consultative Assembly

2020 to date: Advisor to di Leader of di Islamic Republic and full member of di Expediency Discernment Council and member of di Supreme Council of di Cultural Revolution

2005: Presidential candidate. Finished sixth among seven candidates.

1400 and 1403: Disqualified from running for president

August 14, 1404: Secretary of di Supreme National Security Council