Iran fit win America?

Iran

Wia dis foto come from, Reuters/Getty Images

Read am in 5 mins

As di US and Israel kontinu to wage war against Iran, informate neva dey as to which side dey actually win.

US President Donald Trump dey usually tok say im don alreadi finish Iran, particularly as e dey tok say im don scatta Iran air and naval forces, among odas.

Howeva, wit Iran wey neva ready to surrender - dem kontinu to carry out attacks, particularly on US military bases for di Middle East, e make am be like say di fight dey far from ova.

Oga Trump declare say Iran don kpafuka wit claim say Iran don begin dey ask for ceasefire agreement.

Howeva, Iranian officials deny say dem no seek ceasefire, say dem dey prepared to kontinue di war indefinitely.

US President Trump say 'dia air defences, dia naval power, and dia command and control structure don destroy.'

E add say: 'Dem wan negotiate. But I tell dem say di time don pass!'

In response, Iran say dem dey defend diasef by launching attacks on Israel and oda Middle Eastern countries wia di US get military bases.

To understand di true nature of di victories dem achieve by each side, e dey necessary to look back at di history to understand di party intentions and dia objectives why dem enta di war from di outset.

America ambitions for di war

Di objectives of di United States and dia leader, Donald Trump, no dey clear for di war.

Howeva, e dey known say di issues wey dey na about Iran possession of nuclear weapons and di overthrow or regime change of di Iranian govment.

E be like say despite di killing of di kontri religious leader, dem immediately replace am, and di call by Donald Trump and Benjamin Netanyahu for Iranians to rise up and seize di govment no come to pass.

Sabi pipo even believe say di war dey strengthen Iranian unity.

Even bifor di war begin, plenti tok don dey go on between di US and Iran for Geneva in February by Oman, wia dem first achieve breakthrough.

Oman say Iran begin to show willingness to compromise on dia nuclear programme, but e no agree to stop di missile development, or to withdraw support for proxy groups such as di Houthis for Yemen and Hezbollah for Lebanon.

Howeva, e be like say among America main objectives na di removal of di hardline Ayatollahs theocratic govment, and dia replacement wit who dem see say e no dey pose threat to di United States and dia neighbours.

Anoda tin di US go like na to make Iran weak to di point of surrender. But dis too dey very difficult, as di kontri kontinue to show resilience.

Iran blockage of di Strait of Hormuz throw di world into energy crisis, situation wey further show say di US go do evritin possible to open di strait, yet e dey ask di support of oda kontris.

Mohammad Qaddam Siddiq Isa, commentator on Middle Eastern affairs, say di US wan prevent Iran make dem no get nuclear weapons.

Howeva, e say di US no dey move to overthrow di Iranian govment, say e fit lead di change, e go consider dat as victory.

Wetin Israel want?

For dia own part, Israel want make dem sieze and destroy Iran missile and weaken di kontri military influence.

Howeva, dem fit rebuild all di facilities even if dem destroy am, but Israel wan further show Iran say dem dey prepared to destroy dem again, even if dem rebuild dem within few months.

Israel consider Iran missile arsenal and dia ownership of nuclear weapons to be di major threat.

Iran get domestic drone manufacturing industry, as dem dey even supply Russia wit Shahed drones for dia war for Ukraine.

Iran also get enriched uranium of up to to 60 per cent, wey pass di level wey dey required for power generation.

Howeva, Qaddam add say Israel go further dan di US for dia demands, as dem aim for complete overthrow of di Iranian govment.

Di hope of Iran

Iran objectives no dey plenti as dia main aim na to surpass di objectives wey America and Israel dey hope to achieve for di war.

Qaddam say once di war is ova, if di US and Israel fail to achieve dia objectives, den Iran go claim victory for di conflict.

Iran also aim to ensure say dem no dey subject to further attacks for di future.

Di war don shift di economy, as Iran close di Strait of Hormuz.

Iran fit succeed?

As for weda na Iran dey win, Qaddam Siddiq say e depend on wetin each side define as victory.

'For Iran, dia greatest victory na to end di war without di US and Israel achieving dia own objectives,' e say.

Howeva, at di same time as Trump claim victory, e dey also seek di help of European countries and di coalition for di war, particularly regarding di opening of di Hormuz Strait.

Dis don make am difficult to understand di nature of di gains by di parties.

Howeva, odas argue say Iran kontinue dey show aggression for di war, di ongoing blockade of di Strait of Hormuz and di disruption of global energy trade, show say Iran dey also play significant role for di conflict.

One tin about Iran na say di kontri get long history of resilience for war, and na also one of di kontris wey you no fit really understand dia militarily for di Middle East.

One report by di Center for International Studies on military power for 2025 say Iran get approximately 610,000 personnel, including 350,000 wey dey serve for di kontri army and 190,000 for di Revolutionary Guard, wey dey responsible for developing drones and missiles and oda operations for di region.

Iran also rely on regional alliances, including di Houthi fighters for Yemen, Hezbollah for Lebanon, militant groups for Iraq and Hamas.

Nicole Grajewski say despite some of di sanctions wey Iran face, di kontri get long history of enduring long conflict.

Dis dates back to di Iran-Iraq War, wia e come under attack for numerous cities despite dia weakness for modern weaponry.