Nigerian BTS Army join rest of di world to celebrate one of K-pop biggest bands comeback

BTS perform onstage during di 2019 Billboard Music Awards at MGM Grand Garden Arena on May 01, 2019 in Las Vegas, Nevada.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem neva do live performance as a group since 2022
Read am in 4 mins

One of K-pop biggest bands, BTS don come back afta almost four years of hiatus sake of dia compulsory military service.

Di seven man group bin start dia comeback on Friday wen dem drop dia new album wey dem call Arirang and dey start dia tour wit live broadcast of dia concert from South Korea.

Nigerians also organise watch parties as about 260,000 pipo dey expected to attend di Saturday free concert for Gwanghwamun Squara wia RM, Jin, Suga, J-Hope, Jimin, V and Jung Kook go perform for di first time since October 2022.

Even though di large number of pipo dey expected to come, na only 22,000 pipo wey get free tickets to di show go watch di concert gan-gan while di rest go watch am from biggeer screens for outside.

Dis go be di first date in a 82-date-tour wey tori be say fit make di band ova $1 billion.

Di new long awaited album, Arirang na title wey come from one of Korea most loved folk song wey be anthem wey tok about moving from hardship to something beta.

Di first time e dey noted say dem record Arirang for di US na for 1896 and na still seven Korean men sing am for Howard University.

Arirang Abum cover

Wia dis foto come from, HYBE

BBC music correspondent, Mark Savage for im review of di album reason say di group bin refuse to play am safe like dia playlist bifor dem go on military service.

E bin show wit sure hits wey bin be do in di taste to di English speaking markets like Dynamite and butter.

E describe di first 15 minutes of Arirang say e get di rebellious, rap heavy energy of dia album from 2014 wey dem call Dark & Wild as e use two tracks Hooligan and FYA to take make im point.

But di band bin also dey careful to showcase dia homeland afta accusations say dia national identity bin lost from di songs wey dem make bifor dem go on a break.

Apart from di fact say Arirang, di name of dia album na name of cultural song, dem also add di musical notes from di song for di first track of di album Body to Body, as dem include am inside di hip-hip sound of di song.

Anoda way wey di album take honour dia Korean identity na afta di gbas-gbos of di first five songs, di album use di sound of Di Sacred Bell of King Seongdeok wey be one of di kontri national treasure bifor e come enta di next part of di album wey calm down and dey more contemplative.

Oga Savage explain say dis part of di album be like di boy band bin dey worry about how dem go enta back into fame since dia hiatus.

DIs na even as one of di members of di band, JungKook bin recently post and delete livestream wia e bin hala about wetin dey stress am about life as K-Pop Star.

DI last part of di album bin get seductive sexy songs like di music wey shock pipo wey dem call Like Animals but Oga Savage no too feel am for im review say di album use dis part of di album to do some mid tempo love songs wey bin no really gel wit di full package.

Wetin BTS members bin dey do inside dia hiatus

BTS bin dey officially on lockdown for four years even though for South Korea, di compulsory service dey last up to 21 months wey no be complete two years. So wetin happun in dat time.

Well for BTS, all of dem use different times to take join and comot from di military so all seven of dem no go fully dey out of commission for di whole four years.

Na Jin enta im mandatory military service first for 2022 and Suga na di last pesin from di group to finish im service for June last year.

In dat time, all of dem release solo projects and some of dem bin dey very successful.

For instance, di first single of singer JungKook wey im call Seven bin break streaming records wit ova 2.5 billion streams wey increase im total streaming numbers to ova nine billion.

For May 2024, di group leader RM use di hiatus to drop im second studio album wey im call Right Place, Wrong Person.

V drop im own solo album too for September 2023 wey im call Layover.

Jin na di first pesin to enta military service for di group but bifor e join, e follow Coldplay to sing Astronaut but wen e come back, e drop two albums wey be Happy in November 2024, and Echo in May 2025.

Suga wey get di solo name Agust D for April 2023, bicom di first for di group to do solo tour wey im call di SUGA | August D Tour.

J-Hope use di Hiatus to release im first solo album wey im call Jack in di Box for July 2023 and even go on im first solo tour Hope on di Stage, wey finish for June 2025.

Jimin wey im fans dey call am Mochi also drop two albums for dis hiatus. Im first solo album wey im call FACE for 2023 and Muse wey drop for July 2024.