Martial artist and actor Chuck Norris don die aged 86
- Author, Paul Glynn
- Role, Culture reporter
- Read am in 4 mins
Chuck Norris, wey be di US martial artist and Hollywood action star, don die at di age of 86, na wetin im family tok.
Norris bin dey known for im roles for action crime series for di 1990s wey include Walker, Texas Ranger and di 1972 martial arts feem, The Way of the Dragon wia e fight di superstar Bruce Lee.
Im family announce im death "wit heavy hearts" for statement dem post for Instagram.
Dem tok say "e bin live im life wit faith, purpose and unshakable commitment to di pipo im love. Wit im work, discipline and kindness, e inspire millions for world and leaves lasting impct for plenti lives."
Di statement add say, "to di world, e be martial artist, actor and symbol of strength. To us e be devoted husband, a loving father and grandfather, ogbonge brother and di heart of our family."

Wia dis foto come from, Getty Images
Wen dem born am for Oklahoma for 1940, dem name am Carlos Ray Norris, as teenager e enta di US Air Force.
Na wen dem put am for South Korea e start to dey train for martial arts.
E bin win black belts for karate, taekwondo, tang soo do, Brazilian jiu jitsu and judo, and e bin also start im own discipline wey im call chun kuk do.
Im big break for feem start afta e meet martial arts feem star Lee wey invite am to act as di final villian for di 1972 feem.

Wia dis foto come from, Getty Images
Actor Steve McQueen, wey be Norris friend, bin suggest say make e take acting more seriously and na why e go act for di 1977 feem Breaker! Breaker! come act Good Guys Wear Black for 1978.
E gain proper fame afta e act di martial art feems wey dem call A Force of One, The Octagon and An Eye For An Eye, opposite Sir Christopher Lee.
E act oda 1980s feem like Missing In Action, Delta Force and Code of Silence, bifor e go come act as lead character for di TV show Walker, Texas Ranger.
For di show im bin act as Cordell "Cord" Walker wey be beta ranger wey get strong sense of justice for di popular show for CBS wey last from 1993 to 2001.
Meme star
Norris bin also surprise pipo wen e show for di final match of Men Stiller comedy wey im call Dodgeball.
Im final big feem role na for di 2012 feem 2012 movie The Expendables 2 and di soon come Austrailian comedy action feem Zombie Plane.
Apart from feem, Norris bin dey promote fitness, bin start martial arts school and bin dey loud in support of US conservative politics.
And for more recent years, e turn di topic of internet memes wey dem bin dey overhype im power as jokes. Some of di memes na:
- Chuck Norris fit pass eye test wit im eyes close
- Wen di Hulk dey vex well-well, e dey turn to Chuck Norris
- Di flu dey take vaccination against Chuck Norris evri year
- Chuck Norris no dey on shower, e go just look am until e start to cry.
- One time cobra bite Chuck Norris leg, afta e sick well-well for five days, di cobra die.#
Even im grand pikin Grreta Norris use di meme pay her respects for instagram say, "you bin sabi Chuck Norris as di man wey count to infinity twice, di man wey bite cobra and di cobra die. Di world lose icon and I lose my grandpapa."











