Trump hint on end to Iran war as Putin, China react to Mojtaba appointment as supreme leader of Iran

Foto of Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

United States President Donald Trump don dey tok different-different tins bout di war wit Iran as di kasala don reach Day 10.

For comment to different tori pipo ova phone calls, Trump tell tori pesin from di New York Post say, "I get plan for evritin, you go dey very happy", e tell CBS News say di war "dey very complete, pretty much".

E add say, "we dey very far ahead of schedule" but wen dem ask am weda e ggo soon end di operatio bicos of dat, Trump say, " I no know, e depends. Wrapping up dey inside my mind, nobody else."

Just some days ago, Trump bin tok say im no go stop do war till Iran "unconditional surrender".

But afta im comment on Monday, e be like say di end to military operation wey don spread through di Middle East and don also cause di almost complete shutdown of shipping traffic through di Straits of Hormuz, fit dey in the end.

But as evening dey nack, Trump be like say e do about turn.

E tok say, "we go call am ogbonge siccess right now. Or we fit go further and we go go further".

E tok say di US bin dey "very close to finishing" di kasala wey im call "excursion" but im warn di US fit intensify im strikes for Iran kontinu to threaten oil tankers wey wan comot di Persia Gulf.

E tok say, "we hit dem so hard say e no go possible for dme or anybodi elsse wey dey help dem to recover dat section of di world."

Trump also drop say im goal na to make sure say Iran no develop weaponry wey go target US, Israel or any American allies "for very long time".

Las-las dis one go need di kain regime change wey Trump neva fit run so far as dem don replace Ayatollah Ali Khamenei don dey replaced wit im pikin.

Trump don tok say e "no dey happy" wit Iran appointment of Mojtaba Khamenei as dia new supreme leader, according to one programme on Fox News.

Anchor Brian Kilmeade tok say im don follow di US president tok. Afta di announcement, e tell me: "I no dey happy."

Kilmeade no provide further details of wetin im tok wit Trump and di president neva comment publicly.

On Sunday, Iran name Mojtaba Khamenei as im papa Ali Khamenei successor as di new supreme leader.

Di 58-year-old Mojtaba na mid-ranking cleric wit plenty influence inside Iran security forces and wide business networks under im papa.

Armed soja for di Iran Revolutionary Guards as e dey protect one video

Wia dis foto come from, Morteza Nikoubazl/NurPhoto via Getty Images

How Iran respond to dis tok-tok?

On Tuesday, di Iran Revolutionary Guards say dem no go let any oil comot di Middle East until US and Israeli stop dia attacks.

One tok-tok pesin for di Islamic Revolutionary Guard Corps for Iran tok say "na we go determine di end of di war".

According to tori from Reuters, di Iranian Foreign Minister Abbas Araqchi tok say Tehran fit no restart negotiations wit di US "becos we get very bitter experience to tok wit Americans".

E bin tok about di US officials wey report progress for di nuclear tok-tok days bifor Washingtop bin launch dia airstrikes.

E tell PBS say, "still dem decide to attack us. So, I no tink to follow di Americans again go dey our agenda".

Russia, China warn against interference

Russian President Vladimir Putin, on Monday, promise say Russia go stand gidigba wit Iran new supreme leader, Ayatollah Mojtaba Khamenei, wey dem appoint afta US and Israel strike kill im papa.

Putin yarn dis one inside one message wey im send to Khamenei "I go like to reaffirm our unwavering support for Tehran and solidarity wit our Iranian friends." E add say, "Russia don dey and e go still remain partner to Iran."

"At a time wey Iran dey confront armed aggression, your tenure for dis high position go undoubtedly require great courage and serious dedication," di Russian leader tok.

While Chinese foreign ministry tok say di election of Mojtaba Khamenei, as di third supreme leader for Iran na decision based on di kontri constitution, according to di local media for China, Xinhua.

Di minister tok-tok pesin, Guo Jiakun tok dis at di daily press briefing in response to di appointment of Mojbata as di highest leader for Iran.

"China dey oppose interference for oda kontri internal affairs under any pretext, and we go respect Iran sovereignty, security and territorial integrity," e tok.

Who be Mojtaba Khamenei?

So, who be Mojtaba Khamenei?

Dem born am on 8 September 1969 in di northeastern city of Mashhad, and na im be di second of Khamenei six pikin.

E finish secondary school education for Alavi School for Tehran.

At age 17, Mojtaba serve for military for short period during di Iran-Iraq War, according to Iranian media.

Di eight years bloody conflict make di regime dey suspicious of di US and di West, wey support Iraq.

For 1999, Mojtaba go Qom, wey be holy city and wey dey important for Shia theology, to continue im religious studies. E dey notable say e no wear clerical clothes until dis time, and e dey unclear why e decide to attend seminary at 30, as e dey common to go wen you dey younger.

Dis fit make some observers feel say dem wan elevate im religious level and show say e fit be credible candidate for di kontri top leadership.

For di seminary system, to hold di rank of 'Ayatollah' and to dey teach advanced classes na sign say pesin get scholarly level and knowledge, and e dey among di requirements to choose pesin wey go lead.

But dis kind tin don hapun bifor. Ali Khamenei quickly become 'Ayatollah' afta e become di second supreme leader for 1989.