Serious flooding kpai 62 pipo for Kenya as heavy rains continue

A man rides a motorbike through brown flood water next to a damaged car after it was swept away by floods at Grogon garage area, known for automotive workshops and auto spares along the banks of the Nairobi River in downtown Nairobi, Kenya, 07 March 2026.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Na Nairobi di flood hit pass ova di past week
    • Author, Joseph Winter
    • Author, Richard Kagoe
    • Reporting from, Nairobi
  • Read am in 4 mins

At least 62 pipo don kpai for Kenya ova di past week afta heavy rains cause widespread flooding, di authorities tok.

Di previous death toll, wey dem bin release one week ago na 42.

Overnight, dem rescue 11 pipo afta one minibus taxi, wey dem sabi locally as matatu, stuck as water rise for di capital Nairobi, according to di Kenya Red Cross, while dem save two children from one flooded house.

Di heavy rainfall ova di past week don trigger flash floods wey dem neva see for years. Rivers don burst dia banks, and flood homes and damage roads, power - and water-lines.

Dem don close some roads afta bridges bin dey damaged for Nairobi, while some schools bin also dey flooded afta Saturday downpour.

On Sunday, di Interior Ministry say different parts of di kontri don continue to experience heavy rains, and dis don increase di risk of flooding.

Di authorities don urge residents for low-lying areas to move to safer ground and more dan 2,000 pipo don comot for dia houses to seek shelter.

Police say search and rescue operations dey continue afta di "torrential rain and subsequent devastating flooding wey affect various parts of di kontri".

More dan half of dose wey kpai - 33 - bin dey for Nairobi, wia poor drainage don be major factor, along wit di obstruction of rivers caused by unregulated development.

President William Ruto on Sunday say dem dey deliver emergency food supplies and medical assistance to dose affected.

E also say di authorities bin dey clear blocked drainage systems.

No be only Kenya di flooding don affect.

More dan 100 pipo don kpai for neighbouring Ethiopia sake of floods and landslides for di south of di kontri.

Many factors dey contribute to flooding, but a warming atmosphere caused by climate change dey make extreme rainfall more likely.

Di world don already dey warmed by about 1.1C since di industrial era start and temperatures go continue dey rise unless government around di world make steep cuts to emissions.

How you fit stay safe during flood

Bifor you enta floodwater, stop and assess first.

  • Slow down and check how deep di water be
  • Avoid water wey dey deeper dan 6 inches
  • If di water dey move, even 4 inches fit dey dangerous
  • If you no fit see wia di road come out, turn around, no drown

If you gatz drive through, cross carefully.

  • Enta di water slowly
  • Drive at walking speed
  • Follow di part of di road wey dey shallow pass
  • Once you come out of di water, lightly press di brakes to help dry dem

If your car dey flooded, here na how to get out safely:

  • Turn off di engine so water no go enta di engine
  • Unbuckle your seatbelt and unlock all doors
  • If water dey low, carefully open di door and exit
  • If water dey high, climb out through window or sunroof
  • Once you dey outside, move immediately to higher ground and call for help. No try cross fast-moving floodwater on foot

Flooding for house - safety first

  • Move to di highest safe level of your home, such as upper floor or roof if e dey necessary
  • Avoid enclosed attics unless you get way to escape, as rising water fit trap you
  • Shut down utilities to prevent fire, explosions, and electrocution
  • Turn off electricity, gas and water for di main switches/valves
  • Seal your toilets make unsanitary water no go flow up
  • Avoid walking through floodwater as e fit contain sewage, chemicals or debris. If you gatz move through am, wear gumboots or oda protective footwear
  • Keep children far away from floodwaters, as dis fit carry debris and contaminants
  • Monitor local news for updates and contact emergency services