Police begin investigation afta Igbinedion Education Centre expel students inside viral video for bullying fellow student

Wia dis foto come from, Igbinedion Education Centre
Police for Edo State say dem don begin investigate di case of assault for di Igbinedion Education Centre.
Dis dey come afta one video wey bin go viral on social media show wia two students dey beat, kick and drag one boy for ground wey look like say im be junior student.
Inside di viral video, one of di students use belt dey flog di one wey dey for ground while di oda student dey match di victim for chest as im dey cry sake of pain as di one dey record di video dey tell dem say e don do.
For statement on Sunday, di Edo State Police Public Relations Officer, Eno Ikoedem, say di police authorities dey aware of di viral video wey dey spread on social media wey show di disturbing incident of bullying for di school.
"Di Commissioner of Police, CP Monday Agbonika, don direct di Divisional Police Officer wey dey in charge of di area to proceed to di school and make dem start detailed inquiry into di mata," she tok.
"Even though di school don take action, di Edo State Police Command don start comprehensive investigation into di incident.
"Di Command wish to assure di general public say dem go arrest di pipo wey dey involved for di bullying incident and dem go face di law accordingly, in line wit dia respective age and in accordance wit di provisions of di law."
According to Ikoedem, di management of di school maintain say di students wey dey involved in di act of bullying don already dey expelled from di school as part of disciplinary measures wey di school authorities take.
Di Igbinedion Education Centre bin confam for statement say dem don expel di students wey dey inside di viral video.
Dis video generate plenti tok-tok for social media as many pipo condemn di act of bullying for school and oda places.
For statement wey di school release on Friday, dem tok say dem don already expel di students from school.
Di school add say dem dey aware of di video wey dey circulate online wey show di serious incident of bullying and physical assault wey involve students for di school and dem don also report to relevant authorities.
"Di behaviour wey di video show dey veri disturbing and na direct violation of di values and standards wey we dey uphold," di statement tok.
Di Igbinedion Education Centre explain say dem no dey tolerate bullying or any form of violence and intimidation and dem investigate di mata sharp-sharp and swing into action even though di students na minors.
"Following di immediate investigation, we don expel di students from di school wit immediate effect. Our school community no go eva tolerate dis kain behaviour.
Our priority remain di safety, dignity and wellbeing of evri student. We dey provide support for di pipo wey dey affected and dey also work closely wit dia families to make sure say di mata dey addressed wit di seriousness wey e deserve."
Dem add say di school dey cooperate fully sake of say di students na minors.
Dis viral video make Nigerians chook mouth for di mata and one of dem na di House of Representatives member wey dey represent Ovia Federal Constituency, Omosede Igbinedion
For statement wey she post for her verified Facebook page, she tok say she be former student of di school and di incident dey disturb her.
"I find di incident deeply troubling. Igbinedion Education Centre don dey stand for discipline, respect, excellence, and di nurturing of young minds for safe and supportive environment for long. Any act wey undermine dis values gatz dey firmly condemned," she tok.
While she commend di management of di school as dem act fast, she say no form of bullying dey acceptable.
"Our schools gatz remain spaces wia evri pikin feel safe, protected, and respected. Incidents like dis dey remind us of di importance of continuous guidance, proper supervision, and di collective responsibility of parents, educators, and di wider community to shape di character and conduct of our young pipo."
Oda Nigerian reactions for social media tok say bullying dey happun well-well for school and dis one come out becos camera video am.
Bullying dey happun for schools for Nigeria as di kontri don witness some cases. But di one wey shake Nigeria well-well happun for December 2021.
Nigerians bin demand justice sake of Sylvester Oromoni as di Dowen College student bin allegedly die sake of alleged bullying.
Na more dan 180,000 pipo bin sign petitions wey bin demand justice afta di death of di 12-year-old boarding school pupil for Nigeria.
Sylvester Oromoni family bin accuse five fellow students for Dowen College for Lagos say dem torture am becos im no gree join one cult group.
Im death make Nigerians vex and authorities bin close di school indefinitely.
Even afta dis incident, cases of bullying still dey happun and e don dey raise more concern and awareness.









