Senegal approve 10 years in prison for pipo wey dey practice same sex

Wia dis foto come from, Getty Images / Nicolas Remene
Parliament for Senegal don endorse new bill wey go help clampdown on same sex activities for di kontri.
Di new bill double di maximum penalty for same sex relations to upto 10 years in prisons, di old penal code stipulate only two to five years.
Di law make provision for prosecution and sanctions for all individuals and organizations wey dey promote LGBT ideology.
Aside prison sentence, di law also set fines wey reach upto 10 million CFA, unlike di old penal code wey di fine na just 1.5 million CFA Francs.
135 members of parliament vote in favour of di new bill. Di new proposal follow for campaign promises of President Bassirou Diomaye and Di Prime Minister Ousmane Sonko.
Dem bin present am to parliament after plenti arrests over alleged same sex relationships ravage di kontri. Same sex relationship already dey banned under Senegal law.
For two weeks, Senegal face scandal wey involve plenti pipo including public figures wey dem dey suspect say dem be homosexuals.
From February 7 authorities don arrest about 30 pipo ontop di scandal.
Among pipo dem arrest na popular journalists, television presenters and singers ontop issue of unnatural practices, intentional transmission of HIV/ AIDS, endangering lives of odas, drug use and money laundering.
Senegal Police bin announce say de don dismantle one international pedophile network and arrest 14 persons wey be Senegalese nationals.
Dem say dem believe say di individuals dey HIV positive and dem dey linked to one man dem arrest for France ontop pedophile matter.
Di two cases na wetin cause plenti organizations including some religious associations to take stand and call for examplary sanctions to protect children, plenti of whom dem feels say pipo don convert to sexual objects by di "HIV positive individuals.
Plenti kontris get laws wey dey against pipo way dey pratice LGBTQ. For September, Burkina Faso military junta pass one new law wey criminalise same-sex relationships for di Sahel kontri.
about 22 out of 54 African kontris allow same-sex relations, but e dey punishable by death or lengthy prison terms for some kontris.











