Biden inauguration: Joe Biden to reverse Trump Travel ban, other policies after inauguration on Wednesday

Wia dis foto come from, AFP/ Getty
Joe Biden go sign up to a dozen executive orders on im first day as US president.
Biden team bin reveal details of a series of executive orders wey di US President-elect go quickly sign hours afta e don take office.
Dem reveal say part of di tins wey αΊΉ go do na to reverse some of di policies wey Donald Trump signed as president of di United States.
3 Tins Wey Biden Go do Immediately Afta Inauguration
- First of all, Biden go make sure US join di Paris Climate agreement again - dis be a global pact on cutting carbon emissions.
- Biden go reverse di controversial travel ban on a list of mostly Muslim-majority countries.
- E go make am mandatory for pipo to wear masks on federal property and wen dem dey travel interstate to cut Covid-19 infections.
Although, Biden like Trump go fit use executive orders to bypass Congress on some issue, di $1.9tn (Β£1.4tn) coronavirus relief plan wey e announce early dis week go need Congress approval.
E go also need di lawmakers to approve di path to citizenship for millions of migrants wey no get documents.









