Trump drop update about Iran Supreme Leader as US military plane crash kill all six crew members for Iraq

A US Air Force Boeing KC-135 Stratotanker aerial refuelling tanker aircraft dey for Ben Gurion international airport near Tel Aviv, Israel, for February.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, One US Air Force Boeing KC-135 Stratotanker aerial refuelling tanker aircraft dey for Ben Gurion international airport near Tel Aviv, Israel, for February.
Read am in 5 mins

Di US Central Command (Centcom) don confam say all di six crew members wey dey on board di aircraft wey crash for Iraq as e dey refuel, don die.

US bin initially tok say dem locate four of di deceased crew.

Dem say neither hostile nor friendly fire dey involved for di downing of di KC-135 aircraft.

Di tanker bin dey involved for di ongoing US operations against Iran and e be one of di two aircraft wey involve for di incident. Di second one land safely.

Di Boeing-manufactured aircraft dey capable of refuelling planes midair and e normally dey play major role for US military operations.

Dem use dem well-well for di first Gulf War to extend di range of fighter jets and bombers.

For one post for dia X handle, Centcom bin say dem dey investigate di development and dem no go release di identities of di service members wey die until afta 24 hours to first inform dia next of kin.

Earlier on Friday, Centcom bin say "di incident hapun for friendly airspace during Operation Epic Fury", but no be hostile or friendly fire cause am.

Di plane na military KC-135 plane wey dem dey normally use for fight-fight.

Di KC-135 aircraft dey usually get a crew of one pilot, a co-pilot and a boom operator.

Since di US-Israel war wit Iran start, US sojas don die for di conflict.

Di US military don now lose at least four aircraft during di war for di Middle East.

Earlier dis month, dem shoot down three F-15s for "wetin be friendly fire incident" over Kuwait, officials tok. All six crew members eject safely.

Refuelling tankers work na to make sure say jets and bombers get better fuel for combat wey involve long distances to reach dia targets.

Na Boeing build di KC-135 Stratotanker in di 1950s and early 1960s.

E don become di backbone to di US military air refuelling fleet, and critical to dey allow aircraft to carry out missions even without landing.

Iran new Supreme Leader survive assassination

Mojtaba Khamenei

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Mojtaba Khamenei bin dey for di same house wen di airstrike by di US and Israel kill im papa, di former Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei, and e bin wunjure for di attack

Meanwhile, tori be say di new Iran Supreme Leader, Mojtaba Khamenei, dey hospital now afta e survive anoda attempt to kill am.

One lawmaker for di Iranian parliament, Mohammad Kochi tell di BBC say Mojtaba Khamenei "bin dey wit di late Ayatollah Ali Khamenei for di attack wey bin kpai di former Supreme Leader for im house, but e bin survive di assassination".

Oga Kochi also tok say anoda attack hapun for di hospital wia new leader dey receive treament, "but America and Israel no achieve dia goal for dis attack".

Di lawmaker no mention di name of di hospital or di location wia di attack bin hapun.

US President Donald Trump bin don tok for one interview wit Fox News say im know say di new Iran Supreme leader bin injure for di first day of bombing by di US and Israel.

"I tink say e bin injure, but I tink say e probably dey alive in some way," Trump tok.

On Thursday, di Iranian govment issue one written statement from di new Supreme Leader Mojtaba Khamenei sake of say, tori don start to dey fly around about im condition.

Di statement tok say di Strait of Hormuz go remain blocked as a pressure tool against di enemy

Earlier on Thursday, Iran ambassador to Cyprus, Alireza Salarian, tell di The Guardian UK say, im hear say di new Supreme Leader bin get injuries for im legs, hands and arms.

"I tink say e dey for hospital bicos of im injury... I no tink say e go dey comfortable to give speech (under any circumstances)," Salarian tok.

Gulf states report more drone and missile attacks

Irania drone

Wia dis foto come from, Reuters

Iran don also continue to dey target several kontris for di Gulf region wit missile and drone attacks.

Oman state news agency report say two pipo bin kpai afta one Iranian drone bin crash for di Sohar province.

Dem quote one security source wey tok say di drone bin crash for di Al-Awahi Industrial Zone, kill two migrant workers and injure plenty odas.

Oman govment tok say dem shoot down anoda drone for di same Sohar province, and dem dey investigate di two incidents.

Also, alarm sounds bin go off dis Friday morning for di Incirlik Air Base for Turkey according to di kontri news agency.

Dis air base dey located near di city of Adana for southeastern Turkey.

Four days ago, NATO air defense system bin intercept one Iran ballistic missile for di Turkish airspace, and dis na di second of such incident for di past week, and Turkey bin express dissatisfaction wit Iran for dat action.

For Saudi Arabia, di Ministry of Defense announce say dem shoot down one drone wey dey approach di diplomatic area for Riyadh.

One tok-tok pesin for di ministry bin don announce say dia air defenses shoot down eight oda drones for di central and eastern regions of di kontri.

For di past few hours, Saudi Arabia say dem don shoot down more dan 20 drones for various parts of di kontri.