Iran fire missiles to UK-US military base for Diego Garcia

UK Prime Minister Keir Starmer and US President Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty

Read am in 6 mins

Iran launch missiles for di joint UK-US military base for Diego Garcia, according to wetin BBC News now don understand.

Earlier dis month, di UK give di US permission to use di base as well as di Royal Air Force station for Gloucestershire, United Kingdom - for defensive operations to prevent Iran from firing missiles wey go put British interests or lives at risk.

On Friday, di UK agree to allow di US to use British bases to launch strikes on Iranian sites wey dey target di Strait of Hormuz.

From wetin di BBC gada, di attack dey unsuccessful and e happun bifor di UK announce dia expansion to allow America use British bases last night.

Meanwhile, di UK Ministry of Defence no confam or deny di reports say Iran launch missiles towards di joint US - UK military base for Diego Garcia.

For dia statement wey dem release, one of dia tok tok pesin say Iran attacks na threat to di UK interests.

"Iran reckless attacks, wey dey go out across di region and holding di Strait of Hormuz hostage, na threat to British interests and British allies."

Di tok tok pesin say di UK military assets go kontinue to dey defend dia pipo and personnel wey dey di region.

E confam say di UK govment don give permission to di US to use "British bases for specific and limited defensive operations."

According to wetin di BBC gada, di reports say two Iranian missiles dey fired towards di British Sovereign Base for Diego Garcia dey correct, but e no touch di military base.

Wetin be di significance of Diego Garcia military base

Diego Garcia na di largest island for di Chagos Islands archipelago for di Indian Ocean and e dey house joint military base by di UK and US armed forces.

Diego Garcia dey strictly out of bounds to most civilians and dey about 1,000 miles (1,609km) from di nearest landmass.

Di remote island dey di centre of long-running territorial dispute between di UK and Mauritius.

Under di deal between di two nations wey dem announce last May, di UK go lease back Diego Garcia for period of 99 years for di average cost of £101m per year.

Meanwhile, former commander of UK Joint Forces Command say di UK "need to dey certain" if two missiles fired at di joint US-UK military base Diego Garcia na from Iran.

General Sir Richard Barrons tell BBC Radio 4 say Iran missiles get range of 2,000km (1,243 miles) but di base dey about 3,800km (2,361 miles) from Iran.

Iran cut warning give UK say make dem no allow US use dia military bases to carry out attack

Iran don tell di United Kingdom (UK) say if dem allow make United States (US) us dia military bases, e go dey considered as say dem participate for di aggression.

According to di Iranian foreign ministry, dem say make UK no assist di US if not e go matter worse.

Di UK bin agree to allow di US to use British military bases, but only for "defensive" strikes on Iranian missile sites.

Iran say Foreign Minister Abbas Araghchi call am wit im UK counterpart Yvette Cooper, wia e tok say any assistance wey di UK go provide to di US go lead to "escalation of di situation".

Araghchi accuse di UK and oda European nations of "biased approach" towards wetin e describe as "blatant aggression" from di US and Israel.

E dey reported say Iran Minister Araghchi also criticise di UK say dem fail to condemn Israeli strikes on Irans South Pars gas fields.

Howeva, as di US and Israel kontinu to wage war against Iran, informate neva dey as to which side dey actually win, as Trump dey call on oda kontris make dem join hand wit am.

Rumble wit Iran flag for di side

Wia dis foto come from, Majid Saeedi/Getty Images

Meanwhile, UK Foreign Secretary Yvette Cooper warn her Iranian counterpart Araghchi during dia call, say make Iran no attack UK bases.

Dis one sup afta di Iranian foreign ministry release details of di call, including wia e dey warn say if UK allow US use dia military bases, e go mean say dem too dey participate for di aggression.

Di UK Foreign Office say during di call Cooper condemn "Iran reckless attacks", including di strikes against "critical energy infrastructure".

She also call for di "immediate restoration of freedom of navigation" for di Strait of Hormuz and make clear say di UK defensive operations dey in "response to Iranian aggression" against Gulf nations.

Wetin be UK stand on US using dia military bases

Di UK bin agree to allow di US to use British military bases, but dem say e go be only for "defensive" strikes on Iranian missile sites.

Prime Minister Keir Starmer say Britain learn lessons from di"mistakes of Iraq", and no dey involved for di initial strikes on Iran.

On di oda hand, e no dey clear which kain missions di US dey fly out of RAF Fairford, but since plenti of US activity dey go on for di Gloucestershire air base, wit bombers wey dey arrive and taking off from di base.

Di RAF Fairford mean Royal Air Force Fairford and na di Royal Air Force station for Gloucestershire, United Kingdom.

Trump call Nato allie cowards

Oda di oda hand, US Donald Trump say Nato allies na "cowards", say dem no get mind.

Trump say e go dey "easy" for dem to help open di Strait of Hormuz

E say make dem secure di shipping lane, and also reveal say many of dem inform di US say dem no wan get involved.

"Now dat fight dey Militarily won, wit veri little danger for dem, dem dey complain about di high oil prices wey dem dey forced to pay, but no wan help open di Strait of Hormuz, simple military maneuver wey be di single reason for di high oil prices."

""So easy for dem to do, wit so little risk. COWARDS, and we go REMEMBA"

UK say dem no wan get drawn into di war.

Still, Israel dey hit Tehran and oda parts of Iran wit air strikes leading to di death of several top Iranian officials.

Iranian outlets publish for one statement by Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) to confam say Ali Mohammad Naini, di tok tok pesin for IRGC' don kpai for strike.

Naini hold various high-ranking posts bifor e become IRGC tok tok pesin.

Di IRGC na group of military 'personnel wey dey defend Iran.