'Five suicide bombers enta Maiduguri, two still remain' - Governor Zulum

Borno State Govnor, Babagana Zulum say five suicide bombers enta di state and na only three don detonate dia Improvise Explosive Device (IEDs) so far.
Zulum tok inside exclusive interview wit BBC News as e dey react to di recent bomb blast wey hapun for Maiduguri di Borno State capital fr north east Nigeria, wey kill at least 23 pipo and injure about 100 odas wen suspected suicide attack three different places at di same time.
Dem attack di Post Office area, di Monday Market axis and di entrance to di University of Maiduguri Teaching Hospital (UMTH), according to di Nigeria army.
E hapun for around evening period, around di time wey Muslim pipo wey dey do dia normal Ramadan fasting time dey break dia fast.
Nigeria military blame di attack on militants from di notorious Boko Haram group.
For interview wit di BBC Govnor Zulum tok say dem still dey investigate wia di oda two dey and im govment go make sure say dia plan no go work.
According to di govnor, na based on intelligence report wey dem get and dem dey work on am to make sure say dem go scata di plan of di remaining two before dem detonate dia bombs.
"Di intelligence wey we receive so far indicate say five suicide bombers don enta Maiduguri. So far, three don detonate dia IEDs and we dey investigate di whereabouts of di two. I no wan go further, we dey ontop di mata, by God's grace we go scata di two wey dem neva detonate".
End of Di one wey oda users dey read well well
Di govnor wey im state dey face one security challenge to anoda say im feel "very sad", and im bin dey for Saudi Arabia wen im hear about di bomb blasts.
"As di executive govnor of Borno State, di chief security officer of di state, I bin feel so sad. My prayers dey wit di pipo. And therefore, I want to bring hope to di pipo of Borno State, and in particular di pipo for Maiduguri, say di madness go end."
According to di govnor, since im comeback from travel im dey do plenti tok-tok wit di armed forces and oda security agencies and dia aim na to bring di situation, under control.
'E dey difficult to deal wit enemy wey you no dey see'
Di insurgents dey known to target gatherings during festivities like Sallah, large gatherings during Ramadan and election period. As to why govment no dey fit prevent dem from striking, Zulum tell BBC say, "e dey veri difficult to deal wit enemy wey you no dey see face to face."
Im say military operation bin hapun for di Timbuktu Triangle about two months ago and anoda military operation dey go on for di Sambisa Game Reserve.
"Our intention na to make sure say we deal wit di insurgency wey remain bifor raining season go start, because in di next one or two months... access no go dey to go di Sambisa Game Reserve."
Im explain say di insurgents dey enta inside Maiduguri, as dem dey always do during festive periods and becos of di population dem fit dey hide inside wia normal pipo dey stay.
"E dey veri difficult for Nigeria and di Nigerian govment to completely scrutinise almost evribody wey dey live for Maiduguri. However, I want to assure you say we don put measures in place."
'Govment dey continuous'
For di exclusive interview wit BBC, Govnor Zulum say even though President Bola Tinubu travel to UK on a two-day State Visit wen di incident bin hapun and im too bin go di lesser hajj, im deputy bin dey on ground.
Im tok say Vice President Kassim Shettima bin visit Maiduguri and na beta representation of di presence of di President of d iFederal Republic of Nigeria. im add say oda ogbonge pipo like di Chief of Army Staff, di Chief of Defence Staff, and all oda military wey including di Inspector General of Police come Borno to address di situation.
"Nobody dey tok about hundreds of Boko Haram insurgents wey we just kill for Malam Fatore. Within di last two to three months, nothing fewer dan about 300 of di insurgents kpai. So as long as we want to tok about di bad tin, make we balance di report wit di view to understand wetin dey hapun for Borno State".
Di govnor add say Borno State dey more secure now dan before and e don improve wit ova 90%. We still get small-small problems though and im promise say govment go make sure say "dis madnes come to an end."













