Tinubu order security chiefs to Borno State afta bomb blasts kill dozens for Maiduguri

Wia dis foto come from, Nigeria Army
Nigeria President Bola Tinubu don order security chiefs to move to Maiduguri after ogbonge bomb blasts hapun for multiple locations for di Borno State capital, northeast Nigeria, on Monday, leaving plenty pipo dead and many odas wunjure.
Tinubu tok dis one for statementnt wey e sign by imsef dis Tuesday morning as e express sadness and anger for di tori of di terrorist attack.
Di bomb attacks hapun for three different places at di same time - di Post Office area, di Monday Market axis and di entrance to di University of Maiduguri Teaching Hospital (UMTH), according to di Nigeria army.
E hapun for around evening period, around di time wey muslim pipo who dey dia normal Ramadan fasting time dey break dia fast.
Borno State police authorities later release statement late on Monday to tok say at least 23 pipo bin kpai and about 108 pipo wunjure. Locals wey tok to some tori pipo say di number dey far higher.
"I wan make am categorically clear say dis acts of terror na di final desperate and frantic attempts by criminals and terrorist elements trying to instil and spread fear, as dem dey unda constant pressure from our brave armed forces and security agencies operating for various theatres," Tinubu tok.
"We go continue to intensify our efforts against all criminal elements, wiaeva dem fit dey."
Tinubu tok say im administration bin don approve additional equipment and operational support to enhance di capacity of di armed forces.
Di President suppose travel to di United Kingdom dis Tuesday wia e go start im two-day State Visit to di British Royal family, according to one schedule wey di royal family bin release on Monday.
Earlier, di guvnor of Borno State Babagana Zulum describe di attack as "utterly condemnable, barbaric, and inhumane".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Reuters
Witnesses tell Reuters News Agency say di first blast hapun for di post office for di city centre and almost immediately, anoda one hapun for di popular Monday market wey dey near di Post Office.
Den two more bomb blast also hapun for di University of Maiduguri Teaching Hospital, while anoda one strike one area wey di name na Kaleri.
Everitin hapun almost di same time for evening of Monday, 16 March, 2026.
One army tok-tok pesin, Sani Uba, tok say di bombings na by suicide attackers and e add say "troops of Operation HADIN KAI, plus di Nigeria Police Explosive Ordnance Disposal (EOD) Team bin act immediately swiftly to secure and cordone off di affected locations to prevent further harm".
"Medical teams dey currently attend to di victims wey wunjure for various health facilities across di city, while emergency responders dey continue di rescue and evacuation efforts for di affected locations," Uba Sani tok.
"We dey ask members of di public to remain calm but vigilant, avoid crowded areas wia possible and promptly report any suspicious persons, unattended items or unusual activities to di nearest security agency."
Also di Borno State Police tok-tok pesin Nahum Daso Kenneth ask residents of di city make dem "remain calm and avoid di areas (wia di bomb blast hapun) while assessments continue".
E add say afta di incident, combined security operatives don land di affected areas to rule out di presence of any additional threats.
Also emergency responders, wey include National Emergency Management Agency (NEMA) plus di State Emergency Management Agency (SEMA) don carry victims go medical facilities wia dem currently dey receive treatment.
However, BBC don see some gory videos and photos of pipo wey dey affected by Monday bomb blast. Di pictures dey too gory to publish.
For recent days, reports of attacks by different groups of Islamist fighers against di Nigeria Army for Borno State and oda parts of di northeast don dey increase.
Earlier on Monday bifor di tori of di bomb blasts hapun, di military bin don release statement say dem bin repel attacks for di outskirts of Maiduguri by suspected Islamist insurgents.
Di timing of dis bomb attack don raise questions about weda Presido Bola Tinubu suppose go ahead wit im state visit to di United Kingdom dis Tuesday, wia di British Royal family don already roll out plenty ceremony activities to welcome am.
Some political sabi pipo say di trip don bicom sensistive issue as e dey come now wey Nigeria dey face very serious security wahala.
Security sabi pipo also tok say di insurgency - wey don enter im 17th year - dey always change despite say di military dey fight dem seriously since den.
Dis latest bomb blasts don validate di warning wey di Borno State governor Babagana Zulum bin cut give security authorities for Nigeria recently say e be like say im dey see signs say Boko Haram dey plan something.
Di scale and location of dis attacks - deep for inside Maiduguri city - don also shak di residents who bin dey think say di worst years of di insurgency don pass.
For November 2025, fighters wey belong to di Islamic State for di West Africa Province (Iswap) capture and kpai one high-ranking army officer, Brigadier General Musa Uba.
Maiduguri na di capital of Borno State wey be di place wia Boko Haram insurgents bin start dia activities almost two decades ago, and na di major epicentre of terrorists attacks since di insurgency start.








