Caf announce new date for 2026 Women's Africa Cup of Nations

Wia dis foto come from, ABDEL MAJID BZIOUAT/Getty Images
Di Confederation of Africa Football [Caf] don announce new date for di Women's Africa Cup of nations [Wafcon] 2026 wey go happun for Morocco.
For statement wey di governing body for Africa bring out, dem move di date from March 17 to April 3rd, 2026 to di new date wey be 25 July – 16 August 2026.
According to di statement, Caf change di date "afta tok-tok between Caf and dia partners, Fifa and oda stakeholders...".
Caf explain say dem change di dates "to ensure the success of dis important women's competition, in di light of certain unforseen circumstances."
Na for October 2024, di Confédération Africaine de Football give di hosting rights for di Caf Women's Africa Cup of Nations ("Wafcon") 2026 to Morocco.
Dem add say dem dey dey prepare for di 2026 tournament already and all add di pipo wey dey involved dey confident say e go dey successful.
Nigeria Super Falcons na di most decorated women's team for di continent.
Kontris wey qualify for di 2026 Wafcon
Like say evritin bin go as planned, Wafcon suppose start in three weeks time.
Kontris wey dey participate for Wafcon bin don start to prepare ahead of di tournament.
Nigeria and Cameroon bin recently play friendly matches to prepare for di mundial.
and oda kontris wey qualify dey sharpen dia tactics, assess squads and build cohesion ahead of the finals.
Coaches too bin dey about to conclude di names wey dem go release for dia provisional lists.
But as dem don postpone am now e dey left for di kontris to decide weda dem go continue wit preparations or wait till June to resume hostilities.
Di kontris wey don qualify na
Morocco, Zambia, Tanzania, Malawi, Algeria, Nigeria, Burkina Faso, Ghana, Kenya, South Africa, Cape Verde, Senegal, Cameroon, Ivory coast, Mali, Egypt
See di Groups for di tournament
Group A: Morocco, Algeria, Senegal, Kenya
Group B: South Africa, Cote d'Ivoire, Burkina Faso, Tanzania
Group C: Nigeria, Zambia, Egypt, Malawi
Group D: Ghana Cameroon, Mali, Cape Verde










