Shia members march in support of Palestine, Iran supreme leader to mark Quds Day for Nigeria

Members of di Islamic Movement for Nigeria (IMN) join thousands of pipo around di world to mark di International Al-Quds Day, one annual event wey dey hold on di last Friday of Ramadan to show support for Palestinians.
Some members of di Nigerian Shia community wey pipo sabi well as Shiites bin hold procession for di entrance of di National Mosque for Abuja, di kontri capital.
Similar processions also hold across northern Nigerian states, including Bauchi, Kano, Kaduna and Sokoto, to mark Al-Quds Day.
Di demonstrators describe wetin dem dey do as peaceful rally in support of Palestine.
Dem hold Iran flag and dey chant "Free, Free Palestine, We are all Palestine" Some of dem wey include women and children hold placards wey get di foto of di late Iran Supreme Leader, Ali Hosseini Khamenei Ayatollah.
One former tok-tok pesin of di IMN tok say di procession na in "support of Palestinians" and to mourn di death of di late Iran Supreme Leader.
Bifor now, di Shiites bin don hold protest afta Iran Supreme Leader, Ali Khamenei, die during di US and Israeli strikes for Iran.

Police presence bin heavy for di areas wia di march hold to ensure say kasala no burst.
Dis dey come as di US Embassy for Abuja bin earlier don raise security alert and urge local authorities to increase security measures, wey include road closures, traffic restrictions, or increased police presence for areas wia demonstrations go happun.
Di embassy bin also warn dia citizens to remain for house as previous demonstrations by di Shite members bin result to violent clashes wit Nigerian security forces.
Previous Al-Quds Day processions bin turn deadly for Nigeria, wit clashes between IMN members and security forces wey don leave many pipo dead.
Rallies bin take part for oda countries wey include Iran, Malaysia, Indonesia, Kashmir and Yemen. For Tehran, thousands march as di United States-Israeli military campaign enta di 14th day to commemorate di day.
Dis event for long dey associated wit Iran, and na di kontri first supreme leader, Ayatollah Ruhollah Khomeini establish am for 1979.
For UK, di govment bin approve one request from di police to ban di Al Quds Day march for London to prevent "serious public disorder" sake of di conflict for di Middle East, di home secretary tok.
Di Metropolitan Police wey call for di ban, express concern about di high number of protesters and counter-protesters, as dem add say di march organisers dey "supportive of di Iranian regime".
Di Islamic Human Rights Commission, wey dey organise di annual march, insist say na peaceful, pro-Palestinian event.
Dis na di first time UK go ban protest march since 2012. Met tok say dem no take di decision lightly.
Dem name Al-Quds Day afta di Arabic word for Jerusalem. Dem dey observe am on di last Friday of Ramadan.
Dem mark am first shortly afta di 1979 Iranian Revolution and marches now dey hold around di world, wit di largest taking place in Iran.
March organisers, di Islamic Human Rights Commission, describe am as an "international demonstration... in support of Palestinians and all di oppressed around di world".
Calls for make dem ban di march bin grow afta di Hamas-led attack on Israel on 7 October 2023.
Fotos of di protest for Nigeria













