Winners, Sinners and record breakers: Fun facts about dis year Oscars

Actor Michael B. Jordan & filmmaker Ryan Coogler during interview on Wednesday, 2 April, 2025. Jordan dey wear patterned brown cardigan, Coogler dey wear brown checked jacket.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Actor Michael B Jordan (left) and director Ryan Coogler dey nominated for Sinners, dia fifth film togeda
    • Author, Steven McIntosh
    • Role, Entertainment reporter
  • Read am in 8 mins

Hollywood don reveal di nominations for dis year Oscars, wey go honour di feem industry finest stars and movies from di past 12 months.

Di movie Sinners dey lead di way wit record of 16 nominations, breaking di record for di most Oscar nominations, wey dey previously held by All About Eve (1950), Titanic (1997) and La La Land (2016).

One Battle After Another na next wit 13 nominations, while Marty Supreme, Frankenstein and Sentimental Value na di next wit nine, and Hamnet get eight.

Di Oscar awards go take place on 15 March, to be hosted by US comedian Conan O'Brien.

We don put togeda fun facts to get you started ahead of dis year Academy Awards on Sunday.

Facts about 2026 Oscars awards

Nick Wilde (the fox) and Judy Hopps (the rabbit) pictured in Zootopia 2

Wia dis foto come from, Disney

Wetin we call dis foto, Di biggest box office hit for dis year nominees na Zootopia 2 - or na Zootropolis 2?

1. Zootopia 2 na dis year highest-grossing nominated film, as e get$1.86bn (£1.39bn) worldwide.

But di animated franchise get different title for Europe - Zootropolis. Dat na becos of Givskud Zoo in Denmark, wey register di trademark "Zootopia" for di EU for 2009, seven years bifor dem release di first movie.

2. Emma Stone break two records dis year.

Aged 37, di Bugonia star na di youngest woman eva to earn seven Oscar nominations, overtaking Meryl Streep, wey be 38.

Stone don also become di only actress wey her first five Oscar nominations na all for films wey also dey nominated for best picture.

Emma Stone attend di 98th Oscar Nominees Luncheon at The Beverly Hilton in February in LA. She dey wear black jacket.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Emma Stone dey nominated for conspiracy theory drama Bugonia

3. Frankenstein na two centuries in di making.

E get 207-year gap between Mary Shelley 1818 novel and Guillermo del Toro 2025 film adaptation for Netflix.

Dat na one of di biggest gaps between source material and film adaptation for di history of di best picture category.

4. Chase Infiniti get cinema for her blood.

DI breakout star of One Battle After Another dey destined for film career since dem born her.

Benicio del Toro, Teyana Taylor, Regina Hall and Chase Infiniti speak onstage during di 32nd Annual Actor Awards in LA on 1 March. Del Toro dey wear a tux, Taylor get strapless grey and beige dress on, Hall dey wear white and diamante dress, while Infiniti wear gold chainmail dress.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Chase Infiniti (right, wit her One Battle After Another co-stars) get her name from two movies

5. Miriam Margolyes dey get some long overdue Oscars recognition.

Di British actress stars as di titular character for A Friend of Dorothy, nominated for best live action short. But Margolyes neva get nomination as actress.

Miriam Margolyes, award winning actress and writer, attend di Oxford Literary Festival 2025 on March 29, 2025 in Oxford, England

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Miriam Margolyes stars dey nominated for short film

6. Several nominees are very loyal to their directors.

Four of dis year lead acting nominees dey recognised for films wey dey directed by dia long-term collaborator. Di four inseparable pairs na:

  • Ethan Hawke and Richard Linklater (dem make nine films togeda)
  • Michael B Jordan and Ryan Coogler (five)
  • Emma Stone and Yorgos Lanthimos (five)
  • Renate Reinsve and Joachim Trier (three)

7. Jessie Buckley fit become di first Irish winner of best actress.

Previous nominees from Ireland include Saoirse Ronan and Ruth Negga, while Brenda Fricker win best supporting actress for 1989. But no Irish star don win di leading actress category.

Chloé Zhao and Jessie Buckley attend di 83rd Annual Golden Globe Awards at The Beverly Hilton on January 11, 2026 in Beverly Hills, California. Di pair both dressed in silver and dey smile for di camera.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jessie Buckley, pictured wit Hamnet director Chloé Zhao, fit be di first Irish winner of best actress

8. Brad Pitt break 35-year trend.

Di US actor racing thriller F1 appear for several technical categories, but also score surprise best picture nomination.

Di film make am into di top category despite say e no get any corresponding nods for directing, screenplay or acting.

Di last film to do dis na Beauty and di Beast for 1991.

9. KPop Demon Hunters dey go for (double) gold.

Di Netflix smash hit na di favourite to win two categories - best animated feature and best original song for Golden, performed by di movie girl group Huntr/x.

Girl group Huntr/x pictured looking around corner in KPop Demon Hunters

Wia dis foto come from, Netflix

Wetin we call dis foto, KPop Demon Hunters dey expected to win best animated film and best original song for Golden.

10. Rose Byrne, Kate Hudson and Amy Madigan dey fly solo.

All three actresses score di only nomination for dia respective movies - If I Had Legs I'd Kick You, Song Sung Blue and Weapons.

11. Timothée Chalamet na di youngest actor since Marlon Brando to score three Oscar nominations for acting.

Brando na 30, di same age as Chalamet, wen e achieve im third nomination for 1954.

Timothée Chalamet attend di 98th Oscar Nominees Luncheon at The Beverly Hilton on February 10, 2026 in Beverly Hills, California. E dey wear white shirt and blue jacket.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Marty Supreme star Timothée Chalamet dey up for best actor, but lose some momentum in recent weeks

12. Only three Norwegian actors don eva get nomination for Oscar - and two of dem na from dis year.

Renate Reinsve and Inga Ibsdotter Lilleaas dey nominated for dia performances for family drama Sentimental Value.

Di only oda Norwegian actor recognised by di Academy na Liv Ullmann wey dey nominated for both The Emigrants (1972) and Face to Face (1976).

13. One Battle After Another na Leonardo DiCaprio 12th movie to be nominated for best picture - draw level wit Robert de Niro.

The Godfather Part II (1974) na de Niro first appearance for di top category, bifor e kontinue wit films such as Raging Bull, Goodfellas, Joker and The Irishman.

Inga Ibsdotter Lilleaas, Elle Fanning, Stellan Skarsgård, and Renate Reinsve accept Best Intergen/Foreign for Sentimental Value onstage during di 2026 Annual Movies for Grownups Awards wit AARP in Los Angeles. Dem dey all wear white.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sentimental Value stars (left to right) Inga Ibsdotter Lilleaas, Elle Fanning, Stellan Skarsgård, and Renate Reinsve

14. Wagner Moura don join exclusive club.

The Secret Agent star join di select group of best actor nominees from films wey dey entirely speak languages oda dan English.

15. Hamnet dey follow for EastEnders footsteps.

Despite say na mostly original score e get, Hamnet director Chloe Zhao chose 20-year-old piece of music for di film emotional final scene.

Full nominees list for Oscars 2026

Best picture

Bugonia

Frankenstein

F1

Hamnet

Marty Supreme

One Battle After Another

The Secret Agent

Sentimental Value

Sinners

Train Dreams

Best actor

Timothée Chalamet - Marty Supreme

Leonardo DiCaprio - One Battle After Another

Ethan Hawke - Blue Moon

Michael B Jordan - Sinners

Wagner Moura - The Secret Agent

Best actress

Jessie Buckley - Hamnet

Rose Byrne - If I Had Legs I'd Kick You

Kate Hudson - Song Sung Blue

Renate Reinsve - Sentimental Value

Emma Stone - Bugonia

Best supporting actress

Elle Fanning - Sentimental Value

Inga Ibsdotter Lilleaas - Sentimental Value

Amy Madigan - Weapons

Wunmi Mosaku - Sinners

Teyana Taylor - One Battle After Another

Best supporting actor

Benicio del Toro - One Battle After Another

Jacob Elordi - Frankenstein

Delroy Lindo - Sinners

Sean Penn - One Battle After Another

Stellan Skarsgård - Sentimental Value

Best director

Paul Thomas Anderson - One Battle After Another

Ryan Coogler - Sinners

Josh Safdie - Marty Supreme

Joachim Trier - Sentimental Value

Chloé Zhao - Hamnet

Best adapted screenplay

Bugonia

Frankenstein

Hamnet

One Battle After Another

Train Dreams

Best original screenplay

Blue Moon

It Was Just an Accident

Marty Supreme

Sentimental Value

Sinners

Best original song

Dear Me - Diane Warren: Relentless

Golden - KPop Demon Hunters

I Lied to You - Sinners

Sweet Dreams of Joy - Viva Verdi!

Train Dreams - Train Dreams

Best original score

Bugonia

Frankenstein

Hamnet

One Battle After Another

Sinners

Best international feature

It Was Just an Accident

Sentimental Value

Sirât

The Secret Agent

The Voice of Hind Rajab

Best animated feature

Arco

Elio

KPop Demon Hunters

Little Amélie or the Character of Rain

Zootopia 2

Best documentary feature

Come See Me in the Good Light

Cutting Through the Rocks

Mr. Nobody Against Putin

The Alabama Solution

The Perfect Neighbor

Best costume design

Avatar: Fire and Ash

Frankenstein

Hamnet

Marty Supreme

Sinners

Best make-up and hairstyling

Frankenstein

Kokuho

Sinners

The Smashing Machine

The Ugly Stepsister

Best production design

Frankenstein

Hamnet

Marty Supreme

One Battle After Another

Sinners

Best sound

Frankenstein

F1

One Battle After Another

Sinners

Sirât

Best film editing

F1

Marty Supreme

One Battle After Another

Sentimental Value

Sinners

Best cinematography

Frankenstein

Marty Supreme

One Battle After Another

Sinners

Train Dreams

Best visual effects

Avatar: Fire and Ash

F1

Jurassic World Rebirth

Sinners

The Lost Bus

Best live action short

A Friend of Dorothy

Butcher's Stain

Jane Austen's Period Drama

The Singers

Two People Exchanging Saliva

Best animated short

Butterfly

Forevergreen

Retirement Plan

The Girl Who Cried Pearls

The Three Sisters

Best documentary short

All the Empty Rooms

Armed Only with a Camera: The Life and Death of Brent Renaud

Children No More: Were and Are Gone

The Devil Is Busy

Perfectly a Strangeness

Best casting

Hamnet

Marty Supreme

One Battle After Another

Sinners

The Secret Agent