Trump say US no ready to make deal with Iran, warn citizens to comot for 14 Middle East kontris

Donald Tump and Mojtaba Khamenei

Wia dis foto come from, Roberto Schmidt/Getty Images, Iran President Press Office / Handout /Anadolu via Getty Images

Read am in 4 mins

US President Donald Trump don tok say Iran wan make deal but e no dey willing to do so now "becos di terms no dey good enough yet".

Trump make di disclosure to US outlet NBC for one telephone interview on Saturday 14 March.

Though e refuse to say wetin dose terms be, Trump say Iranian commitment to abandon any nuclear ambitions go be part of a potential deal.

Inside di same interview, Trump also say several kontris don commit to help secure di Strait of Hormuz, though e refuse to name dem.

Trump also say di US don "totally demolish" Kharg Island - wey be critical hub for Iranian oil exports - but add say "we fit hit am a few more times just for fun".

On rising oil prices, di US president say: "So much oil, gas dey - So much dey out dia, but you know, e don dey clogged up a little bit. E go dey unclogged veri soon," e tok.

Meanwhile, di US embassy for Baghdad don issue fresh warning for dia citizens to leave Iraq afta missile hit di embassy building earlier on Saturday.

For dia warning, di US embassy say make citizens "leave Iraq now".

"US citizens wey choose to remain for Iraq dey strongly encouraged to reconsider in light of di significant threat posed by Iran-aligned terrorist militia groups," di embassy write.

As Iran don launch strikes at US targets across di Middle East, di US don urge dia citizens to leave more dan a dozen of kontris for dia.

Separately, di US on Saturday say dem don order non-emergency govment employees and di relatives of govment employees to leave Oman, according to Reuters.

Map showing Middle East countries

Trump raise questions about Mojtaba Khamenei fate

For di same interview with NBC, President Trump bin raise questions about di fate of Iran new supreme leader, Mojtaba Khamenei, di son of Iran slain former leader, Ayatollah Ali Khamenei.

"I no know if e even dey alive. So far, nobodi fit show am," Trump tok becos Khamenei bin issue im first statement via writing instead of speaking on camera on Thursday.

"I dey hear say e no dey alive, and if e dey, make e do somtin veri smart for im kontri, and dat na to surrender," Trump add, bifor e describe di news of Khamenei death as "rumour".

How kontris respond to Trump call to secure Strait of Hormuz

Inside one post ontop im platform Truth Social on Saturday, Trump write say e hope say five kontris - China, France, Japan, South Korea and di UK - go send warships to di Strait of Hormuz so e "no go longer be threat" by Iran.

Dis na how some of di kontris don respond so far:

UK: "As we don tok previously, we dey currently discuss wit our allies and partners a range of options to ensure di security of shipping for di region," a UK Ministry of Defence tok-tok pesin tok.

China: One tok-tok pesin for di Chinese Embassy for Washington tell CNN say China dey call for immediate cessation of hostilities.

Di tok-tok pesin no tok weda Beijing go accept Trump request, but say parties get responsibility to ensure stable and unimpeded energy supply, and add say China go continue to strengthen communication wit relevant parties.